Who be President General of Ohanaeze Ndigbo Emmanuel Iwuanyanwu wey die

President General of Ohanaeze Ndigbo Worldwide, Emmanuel Iwuanyanwu don die.

E die on Thursday at di age of 82 years-old for Abuja, Nigeria capital, family of di deceased confam for one statement on Thursday.

“Di Iwuanyanwu family of Umuohii Atta, in Ikeduru Local Government Area of Imo State announce di demise of our patriarch, Engr Chief Emmanuel Chukwuemeka Iwuanyanwu-Ahaejiagamba Ndigbo,” im son, Jide Iwuanyanwu tok.

“Chief Iwuanyanwu die on Thursday July 25, 2024 afta brief illness.”

“E die at age 82. Chief Iwuanyanwu bifor im die, na di President General of Ohanaeze Ndigbo worldwide and President of Owerri Peoples Assembly.”

President Bola Tinubu don send im condolence message to di family of Emmanuel Iwuanyanwu, wey die on Thursday.

Ajuri Ngelale, tok-tok pesin to di president, tok say Iwuanyanwu na accomplish businessman and dem go always remember am for im legacy

“Chief Iwuanyanwu na di President-General of Ohanaeze Ndigbo Worldwide. E be accomplish businessman and notable politician,” di statement tok.

“President Tinubu condole wit di Imo State goment, di friends and associates of di deceased, and Ndi Igbo over dis irreparable loss.”

Also, Abubakar Atiku, presidential candidate tok say e dey sad ova di passing of Emmanuel Iwuanyanwu.

Di former vice-president ontop im X page tok say e join odas to sympathise wit di family of di deceased and pray to God make im grant di family di fortitude to bear di loss of dia papa

E tok say e be renown man wey pipo sabi for im uprightness, firmness, and industry.

“E be smart businessman, philanthropist and consumate politician,” Atiku tok.

“My condolences go to di Ohanaeze Ndigbo, wey e lead wit distinction until im last breathe, also di goment and pipo of Imo State. May im soul rest in peace.”

Similarly Peter Obi, former governor of Anambra state tok say im dey sad ova di death of president of Ohanaeze Ndigbo Worldwide.

E tok say di deceased na papa to many, but also bridge builder wey dey committed to di peaceful coexistence of all groups in di nation.

“E be patriotic Nigerian wey desire for justice, equity, progress and development of di nation beyond tribal boundaries. Chief Iwuanyanwu na one of my father figures wey dey always give me useful advice. I remember wen I visit am for hospital, on di 11th of dis month wit diSecretary General of Ohaneze Ndigbo Worldwide,” Peter Obi tok

Peter Obi tok say dem bin condole wit di immediate family, of di Ohaneze Ndigbo Worldwide, and di entire nation ova di death of di patriarch.

Immediate past president of Nigeria, Mohammed Buhari mourn president-general of Ohanaeze Ndigbo, Emmanuel Iwuanyanwu.

Buhari tok about di deceased contributions to journalism, sports, politics and nation-building as visionary leader wey revolutionised di nation media and sports.

“I don follow am tok on several opportunities to know about im passionate commitment to di unity, peaceful coexistence, and development of Nigeria,” Buhari tok.

“Im rich contributions don leave great marks on di media, sports, politics, and business, wia e make extraordinary achievements.”

“My condolences to im family, friends and associates, and di entire pipo of di South-east. Im death na loss to di Federal Republic of Nigeria.”

Chief Emmanuel Iwuanyanwu profile

Oga Iwuanyanwu na from Atta, one community for Ikeduru Local Government Area of Imo State.

Bifor e become di president-general of Ohanaeze Ndigbo, im be di chairman of Council of Elders of Ohanaeze Ndigbo.

E be graduate of Engineering from di University of Nigeria, Nsukka.

Oga Iwuanyanwu, na di founder of Iwuanyanwu Nationale Football Club, now Heartland Football Club, wey don win several local and international championships.

Emmanuel Iwuanyanwu, na elder statesman, for president-general of Ohanaeze Ndigbo, di Igbo socio-cultural organisation bifor im die.

Im emerge as president-general of Ohanaeze Ndigbo on 17 April, 2023, afta George Obiozor die.

George Obiozor, di former president-general of di organisation, die for December 2022.

Di late Obiozor, na from Imo state, and im four-year term suppose expire for January 2025, bifor dem go begin rotation among Anambra, Enugu, Abia, Ebonyi, Rivers and Delta states.

Di octogenarian na di publisher of Daily Champion newspaper.

Source