Kaduna strike: Governor El-Rufai tweet as NLC workers strike ‘shut-down’ state

Picture collage of workers dey protest for Kaduna and empty street

BBC

Kaduna state Governor, Nasir El-Rufai don respond to di industrial action wey workers begin for di state on Sunday midnight.

Di govnor tweet say di KDSG tok again say di conditions wey make dem rightsize no change becos of di NLC campaign of economic and social sabotage.

Dis statement from goment dey come as workers for di state dey on a five-day warning strike. Di strike according to NLC chairmo Comarade Ayuba Magaji, na for goment to reverse dia decision and recall back di workers.

On day one of di protest, workers march enta street with placards as dem waka go di state house of assembly to complain.

Meanwhile, light no dey and some petrol stations shut down for di state as di worker unions begin dia industrial action.

Di last time wey pipo for Kaduna see light from electricity na Saturday and fuel stations also dey locked as workers union for di state dey protest di sack of thousands of workers by di state goment.

Workers dey protest for Kaduna

BBC

BBC Pidgin tori pesin report say activities low on Monday morning for Kaduna, activities dey low compared to how every working Monday suppose be.

Public schools also no open as National Union of Teachers don also join di strike, oda places like banks and hospitals go also dey affected considering their unions don join di strike too.

Banner wey some of di workers carry on di first day of di strike

BBC
Banner wey some of di workers carry on di first day of di strike

NLC chairmo Ayuba Sulaiman bin tell BBC say, ‘no going back’ on di five day warning strike and dia plan na to ‘shut down’ di state from Sunday midnight especially as e be say di state goment neva still call dem for negotiation or dialogue.

“Di state goment just wake up and decide to sack over 7000 workers, without any notice or severance payment. Dis pipo na human beings too with families and pipo wey dey depend on dem, so na very bad decision.

“Dis na why we dey embark on dis strike and many of our sister unions don chook mouth for di mata and ready to join us unless di state goment reverse di sack.”

“At di moment, di state goment neva reach out to us for talks or negotiation but anytime dem wan tok we dey ready.” E tok.

Kaduna street on first day of strike

BBC

Wetin hapun?

Kaduna goment say dem take di action because di money wey dem dey spend monthly to dey maintain workers too much and e no dey reasonable.

For statement wey commissioner of local goment for di state release e tok say, every month, 84-96% of money dem dey get from federal goment dey end up as salary for workers and oda allowances and dem need to act.

Kaduna goment add say, di strike no go achieve anything as far as dem dey concerned and dem go work with security pipo to arrest pesin or pipo wey go wan use di strike mata take cause trouble.

Governor El-Rufai

Kaduna state govt

How dis strike go affect Kaduna?

From circular wey we take eye see, at least eight oda associations go join NLC for di strike.

See di list:

  • National Union of Food Beverages and Tobacco employees
  • Nigeria Union of Local government employees
  • Nigeria Association of Nurses and Midwives
  • Nigeria Union of Electricity employees
  • Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas workers
  • Radio Television and Theatre arts workers
  • Amalgamated Union of public corporations
  • Non academic staff unions of educational and associated institutions

NLC don also ask motorcycle and keke riders to join di strike and dis wan wey fit bring di whole state to a standstill.

Abu Sani na resident for Kaduna and e tell BBC say, e dey go market to buy food keep for house as e no know how tins go be from Sunday.

“Everybody for Kaduna dey tok about dis strike and how e go affect ordinary man, so na im I decide to go buy food keep for house at least I know say I dey covered for dat side.”