How Kenya Senate go debate impeachment motion against Deputy President Rigathi Gachagua

Rigathi Gachagua

Getty Images

Kenya Senate go today, debate di impeachment motion against Deputy President Rigathi Gachagua.

Na di final step to remove di deputy president from office.

Majority bin vote for di National Assembly last week to approve im impeachment, e set di stage for di two-day trial for di Senate wey go decide whether or not to comot am.

Di deputy president dey face 11 charges including corruption, causing ethnic divisions and undermining government – all of wey e don deny.

Dis dey happun afta e recent fallout with President William Ruto, wey never tok anything about di matter.

Gachagua trial dey happun before di full house of di Senate after e abandon a process to set up one 11-member committee to investigate di charges.

Proceedings don start and di charges go dey read out plus opening statements from both sides.

Sabi pipo expect di deputy president impeachment to stand as di ruling party senators dey likely to get backing from di main opposition as e happen wen di lower house vote on di case.

How di impeachment motion for Senate go happun

From 12:00 local time (09:00 GMT) on Wednesday, dem go introduce and examine evidence by di National Assembly against Gachagua, including any witness, for three hours followed by another two hours of cross-examination.

On Thursday, di trial go resume to deal with di evidence and witnesses from Gachagua side until late afternoon.

As di process dey conclude for evening, senators go debate di motion for about two hours and den dem go vote – e dey scheduled to happen on Thursday night from 20:30 local time.

Senate fit decide to extend di process to Friday, di last day e fit legally extend di matter.

At least two-thirds of di 67 Senate members must approve di motion for Gachagua to dey removed from office.

If dat one happen and im impeachment stand, e go dey banned from ever holding public office.

E dey expected to challenge di impeachment for court if e pass.

Di deputy president don make plenty unsuccessful attempts to stop di impeachment process, with at least 26 court cases wey don dey filed so far.

On Tuesday, one judge rule say di court no go interfere and say make di Senate proceed with im constitutional mandate.

And just before di process begin on Wednesday, one three-judge bench also refuse a similar request.

Why dem wan impeach Rigathi Gachagua

Some of di grounds for Gachagua impeachment include accusations say e acquired assets worth 5.2bn Kenyan shillings ($40m; £31m) in di two years since e become deputy president – allegedly wey e acquire through corrupt means.

E don explain, including during im trial for di National Assembly, say most of di properties in question na from im late brother estate.

Di deputy president na rich businessman from di vote-rich central Mount Kenya region.

In just five years, e rise from being a first-time MP to become di number two for Kenya leadership, after Ruto pick am as im running mate for di August 2022 election.

At dat time, e bin dey battle corruption allegations for court wey dem later drop after e become di deputy president.

Im impeachment trial don dominate di discussions of many Kenyans and di media in recent weeks.

Some see di high political drama wey di matter don cause as a distraction from di economic concerns of di majority of Kenyans struggling with di high cost of living.

For June, Kenyans enter streets inside deadly protests wey burst over unpopular tax hikes, and wey expose quarrel between Ruto and Gachagua.

Gachagua now dey face accuse of undermining di work of di security agencies with di remarks e make at di time blaming di intelligence agency.

Source