Why Court order Very Dark Man to remove defamation videos about Femi and Folarin Falana

One Ikeja High court for Lagos, Nigeria, don order online content creator, VeryDarkMan, make im no circulate or publish any defamatory or lie lie video or comments about Lawyer Femi Falana, wey be Senior Advocate of Nigeria, again.

Di court also give VeryDarkMan wey im real name na Martins Vincent Otse, di same order for Folarin Falana wey pipo sabi as Falz.

Court sama dis order sake of one social media post wey di blogger do on 24 September, wey claim say Femi and Folarin Falana (wey be father as son) bin follow divert justice wit popular Nigeria cross dresser Idris Okuneye aka Bobrisky wey bin face alleged money laundering case.

Inside di video wey bin land Very Dark Man inside kasala, im bin mention di papa and son names as im bin dey para odey alledge say dem help Bobrisky dodge justice.

“In everytin and everyone wey dem mention here, I go dey disappointed if true true, FALZ and im papa get hand for dis whole Bobrisky issue…..Falzthebahdguy contact Bobrisky and and contact im papa, Femi Falana spoke to Bobrisky in order to divert justice,” in tok.

Justice Matthias Dawodu wey bin hear di case bin also order Very Dark Man to remove di defamatory video/comments wey e bin don post on 24 September about Oga Femi Falana from all im online social media handles and pages pending compliance wit di Pre-Action Protocol of di Court.

Court also grant Femi Falana permission to serve di defendant all di documents wey involve di mata through im lawyer Deji Adeyanju Esquire for Abuja.

VeryDarkMan bin base im comments on one supposed leaked audio recording wia di cross dresser bin allegedly say im pay bribe of 15 million naira ($9000) to di authorities to drop charges against am, plus give am private apartment instead of prison.

Bobrisky wey get more dan five millions followers for Instagram don deny say na im voice dey di audio.

Femi Falana wey be di claimant for di case na Senior Advocate of Nigeria, former National President of Committee for di Defence of Human Rights and former President of West African Bar Association.

Di defendant wey dey describe imself as “Online Police” get plenti online followers, many of dem na impressionable Nigerian youth and young adults.

But according to di court: “Di Defendant no be activist ONLINE POLICE NOT AN ACTIVIST on im lnstagram page”.

“ Di Defendant no get any verifiable physical address but dey very active on many social media platforms.”

On di part of Folarin Falana aka Falz, di court say di dem call di claimant to di Nigeria Bar for 2012, and im na rapper, musician and actor.

Falz start im music career for 2009 and in don win several awards, including Best Rap Single for di 2015 Headies Awards, three MTV Africa Music Awards for 2016, and four awards for di 2017 Nigeria Entertainment Awards.

Wetin bin happun

On September 23, Verydarkblackman for one viral video for on social media, bin play one audio recording wey involve two pipo.

E claim say na Bobrisky dey tok wit somebodi, claim wey BBC no fit confam.

For di video, di alleged cross dresser voice dey tell di oda pesin say im pay 15 million naira to unnamed EFCC officers to avoid prosecution for alleged money laundering.

Allegation wey make Nigerians para, and goment agencis like Economic and Financial Crimes Commission (EFCC), Nigerian Correctional Service, Minister of Interior and Nigeria lawmakers chook mouth for di mata to torchlight wetin happun.

Nigerian Correctional Service, (NCoS) suspend two of im senior officers for dia maximum and minimum security custodial centres.

While di kontri House of Representatives begin probe di bribery allegations against di Economic and Financial Crimes Commission and di Nigerian Correctional Service.

Wetin be di Issues for dis mata?

According Lawyer Jiti Ogunye, dis mata get serious legal implications for pipo wey dey directly involved.

E say, Very Dark Man no be debt recovery agency. Who make am authority to use telephone conversation to blackmail pipo to pay money or settle debt?

If pesin dey owe pesin di law require you to hire lawyer to recover your debt or you make di pesin to pay penalty or damages.

Ogunye say, im feel say wetin Bobrisky do na say im bin dey beg money and lie to convince di pesin to give am di money by name dropping.

But according to am, di defendant bin no try find out weda na so di mata be before im enta social media to scandalize am.

Social media platforms dey usually get plenty misinformation wey dey sometimes include defamation of di pesin wey be topic of discussion.

Lawyer Ogunye draw ear give Nigerians say na offence to invade pipo telephone conversation, dia letters or video and post am for social media under dubious name to call am corruption.

“You no be police,” im tok.

Source