Wetin we sabi so far about di fresh shootings for Imo state

Tensions remain high for Imo state, south east of Nigeria, as heavy shooting wey don claim di life of at least four pipo, for different parts of di state, continue for di number three day on Wednesday.

Eyewitnesses report say gunhots bin dey sound for Wetheral Road, Bank Road, Douglas Road and Ikenegbu Road all for inside Owerri di Imo state capital on Wednesday as gunmen enta town begin shoot.

But di Imo State Police Public Relations Officer, Henry Okoye tell BBC Pidgin say no gunshots happun today at all, say all na rumours pipo dey carry about to create tension.

Afta di proscribed Indigenous Pipo of Biafra (IPOB) bin declare three days sit-at-home, wey bin suppose start on Monday 29 July enta Wednesday 31 July, Imo state don witness killings inside dis three days.

Earlier today, fear nearly finish pipo wey dey live for Owerri as gunshot suddenly begin sound for different parts of di city without warning.

On Tuesday, reports say gunmen kill three pipo for two separate surprise attacks wey happun for Orji, Ekemele and Nwaoriubi inside three different local goment areas Mbaitoli, Ikeduru and Owerri North.

Dem also burn goment motor plus kidnap one driver afta dem burn im car.

Among di dead na one policeman, one businessman and di husband of di immediate past state woman leader of di Pipo Democratic Party.

Di Tuesday killings dey come just less dan 24 hours afta gunmen kill four policemen plus one woman wey dey do Point of Sale (POS) business on Monday for Irete.

Local tori pipo report say as di gunmen dey shoot, dem bin dey shout order to di area pipo say make evribody sidon for dia house, no come out during di sit-at-home if dem love dia life.

Although states for di violence-prone south east don dey observe sit-at-home order wey Ipob impose on dem for over one year now, tins bin cool small since di past few months as though dem relax di order small.

Di Nigeria Police Force wey confam di violent shootings, say di Commissioner of Police for Imo State Command personally lead im men go wia di shootings happun.

Di security outfit promise say dem go deal wit all di jaguda pipo wey get hand for di attacks and killing of dia colleagues plus innocent civilians for di state.

Di kain tok from police dey very common for all di mata wey concern insecurity for di kontri.

But even wit all dis kain hard tok, di insecurity situation for di kontri dey increase and spread day b day.

Source