First Half
Japan 3-1 Nigeria
45+6 Referee blow whistle first half don end.
45+ 6 Michelle Alozie of Nigeria do solo run,pass di ball to Asisat Oshola but Asisat no reach di ball.
45+ 4 Japan 3-1 Nigeria
45+4 Demehin of Nigeria don foul Japan player, referee blow freekick against Nigeria. Katagawa of Japan play di freekick and she score!
45+2 Japan don collect ball from Nigeria but e lstrike land for Chiamaka Nigeri goalkeeper hand.
45+1 Asisat Oshoala get chance to draw level but di Japan defenders too plenti, dem force Nigeria play di ball go backwards.
45′ Referee add 5 minutes.
44′ Game don change as Nigeria don begin come out to attack with few minutes to end first half.
Japan 2-1 Nigeria
42′ Goal! Nigeria don score, Echegini fire di ball inside net afta midfielder Christy Ucheibe give her pass.
40′ Rasheedat Ajibade of Nigeria dey try run go front to attempt goal but Japan dey worry.
38′ Asisat Oshoala of Nigeria dey worry di Japan defence but Nigeria neva get di result dem want.
35′ Nigeria get chance but noting come out.
Japan 2-0 Nigeria
32′ Goal for Japan Mina Tanaki double di lead
Japan 1-0 Nigeria
22′ Goal! Japan don score, Ueki pass di ball to Hamano wey fire shot inside di Nigeria net
20′ Chance for Japan! but Nigeria defender head di ball enta corner kick. Hayashi of Japan play di corner kick but e go few inchesabove di right post.
19′ Japan carry ball from midfield drive to Nigeria goal area, play shot but e land for Nigeria goalkeeper Chiamaka hand.
17′ Japan dey try hard to drag Nigeria players out but e neva work. Japan get freekick.
16′ Nigeria and Japan dey drag ball for midfield sake of say both teams no gree open dia defence.
14′ Foul against Japan as Moriya push Rasheedat Ajibade of Nigeria fall, referee blow foul.
14′ Foul against Japan as Ueki push Michelle Alozie of Nigeria down.
12′ Maika of Japan play one long ball but na off-taget as e go wide out of play.
10′ Throw-in for Nigeria, Okeke play am , Japan intercept di ball , Nigeria collect amback di ball go out of play, throw -in for Nigeria again dis time Michelle Alozie take am.
8′ Osinachi Ohale of Nigeria defend ball wey Ueki of Japan ply near di goal post.
7. Tanaka of Japan cross give give Hamano wey fire di ball straight to di post but Nigeria goalkeeper Chiamaka catch di ball without stress.
5′ Nigeria Super Falcons dey attack Japan from all angles but Japan too no wan give dem space.
2’ Nigeria don begin attack from di first minute as Rasheedat Ajibade cross ball to Asisat Oshoala but Japan defender block di ball.
1’ Referee don blow whistle match don start
Wit two defeats for dia first two group games vs Spain and Brazil, di Super Falcons of Nigeria get tough task for dia last group game against Japan.
For Group C, Spain dey lead wit 6 points from two games, Japan and Brazil both get 3 points but Nigeria neva get any point.
Only a win for Wednesday, 31 July game go give di Super Falcons some hope – anoda defeat go see dem pack dia bags to leave Paris.
A win for Japan go see di Asian kontri qualify for di quarterfinals.
Head-to-head
Nigeria and Japan bin play dia recent game – wey Japan bin win dat game 2-0 for one friendly match on 6 October 2022.
But di Super Falcons bit beat Japan 1-0 during di 2004 women Olympic game for Greece.
Dem go hope say dat piece of history go dey dia side as dem face Japan.
Bifor Japan arrive for di Paris Olympics, dem bin win all dia three games.
- Paris Olympics 2024 football group table
- Full football fixtures of 2024 Paris Olympics
- Who be di Nigerian Arsenal ‘wonderkid’ wey dey linked to Manchester United?
Dem beat New Zealand two times – 2-0 on 31, May 2024 – and 4-1 on 3 June, bifor dem beat Ghana 4-0.
So far for dis tournament, Japan beat Brazil 2-1 wey dem lose 2-1 to Spain for dia group.
For di Super Falcons of Nigeria, dia form never good.
Bifor di Olympics, dem beat Australia for friendly in July 2023 wey dem play scoreless draw wit Republic of Ireland for 31 June 2023.
For di Olympics tournament, Nigeria lose 0-1 to Spain and also lose by di same score line to Brazil.
Super Falcons Coach Randy Waldrum dey hope say im players go find dia scoring boots against Japan.
Dem bin struggle to find di back of di net so far and dem neva score for dia last three international games.
Despite dia first two defeats, coach Waldrum say, “We bin lose to two of di best teams for di world but we don show say we get somtin wey show say we fit to play against anybody for di world.”
Japan go qualify to di quarterfinal if dem win or draw dis game.
If dem lose, dem go hope to qualify on goal difference in second or as one of di two teams wey fit to qualify from di third spot.
For Nigeria, na must-win game if dem get to progress to di next stage – either by goal difference for di second spot or from di third spot.
Line Ups
Japan starting 11: A. Yamashita, R. Ishikawa, S. Kumagai, H. Takahashi, H. Kitagawa, M. Moriya, H. Hayashi, Y. Hasegawa, M. Hamano, R. Ueki, M. Tanaka
Nigeria startling 11: C. Nnadozie, C. Okeke, O. Ohale, O. Demehin, M. Alozie, D. Abiodun, C. Ucheibe, T. Payne, J. Echegini, R. Ajibade, A. Oshoala
How di group C fit end afta group games
Brazil go also face Spain for dis group on Wednesday, 31 July.
Brazil go move to di next round if dem win or draw.
If dem lose, dem gatz to hope say dem finish second on goal difference or qualify as one of di best third-place teams.
For Spain, dem don already qualify.
Di world champions already enta di quarterfinal wit 2 wins from dia first 2 games.
La Roja go top di group if dem win or draw di game wit Brazil.
Brazil capitan and Olympics record player Marta tok say, “We gatz give am evritin as a group – na so football dey. Anytin fit to happun.”
Di match go happun 4PM WAT di same as di oda group game wey be Spain vs Brazil.