Di Tarzan star Ron Ely wey die at age 86

Foto of di late Ron Ely  wey die aT 86 years

Getty Images

United States actor Ron Ely, wey pipo sabi well well for playing di role of Tarzan in di 1960s television show of di same name, don die at age 86.

“Di world don lose one of di greatest men wey pipo ever sabi – and I don lose my dad,” di actor daughter, Kirsten Casale Ely, tok for Instagram post.

Tarzan bin originally show for di NBC television network from 1966 to 1968. During dat time di actor bin break a number of bones and dem bin report say animals attack am wen im bin dey perform im own stunts.

Afta im retire from acting in 2001, Ely become an author and im bin publish two mystery novels.

Ely bin return to acting for one television feem, Expecting Amish, for 2014, wia im play di role of an Amish elder but im return to acting na short one.

For 1980s, im bin appear for oda hit television programmes including cruise ship-based comedy The Love Boat, as well as Wonder Woman with star Lynda Carter.

Na for Texas dem born am for 1938, Ely marry im high school sweetheart for 1959, bifor dem divorce two years later.

Dem bin also sabi am for hosting di Miss America pageant for di early 1980s, wia im meet im second wife Valerie Lundeen. Di couple get three children.

Dia son Cameron bin stab im wife Lundeen to death wen she dey 62 years, for dia house for California for 2019. Police shoot am to death afta dem see am as a threat.

Ron Ely bin file a wrongful death lawsuit against di force, but di judge bin rule say di officers act in self-defence.

Di Tarzan star die for im house for Los Alamos for Santa Barbara, California on 29 September.

Announcing di death on Instagram post on Wednesday, di actor daughter say: “My father na pesin wey pipo dey call hero. Im be actor, writer, coach, mentor, family man and leader.”

She add say: “I sabi am as my father – and na heaven sent honour wey be im. For me, im dey hang for di moon.”

Source