Who be Bianca Ojukwu and why president Tinubu reshuffle im cabinet

Tori say president Bola Tinubu reshuffle im cabinet don pass but reactions of Nigerians don kontinu to grow.

While some Nigerians dey praise di move of di president, some dey tok for social media say di cabinet reshuffle no dey necessary sake of dem don loose hope for di kontri.

According to di president, di change dey necessary as im goment wan carry out one eight ‘far-reaching’ actions wey go give new energy to im administration capacity for optimal efficiency.

E say dis na in line wit im commitment to deliver on im promises to Nigerians.

Di cabinet reshuffle dey come at di time wen Nigeria dey face one of im worst economic crisis wey see kontri pipo dey battle wit over 32.7 percent inflation rate.

And food prices wey don almost reach four times di cost for 2023.

Part of di change for Tinubu cabinet na di sack of five ministers including di minister for Women Affairs, Uju-Ken Ohanenye.

Di eight actions wey President Tinubu approve

1. Di renaming of di Ministry of Nigeria Delta Development to Ministry

of Regional Development to oversee di activities of all di Regional Development Commissions. Di Regional Development Commissions to dey under di supervision of di new Ministry na; di Niger Delta Development Commission, di South East Development Commission, di North East Development and di North West Development Commission.

2. Di immediate winding up of di Ministry of Sports Development and di transfer of im functions to di National Sports Commission in order to develop one ogbonge sports economy.

3. Di merger of di Federal Ministry of Tourism and di Federal

Ministry of Arts and Culture to become Federal Ministry of Art, Culture, Tourism and di Creative Economy;

4. Di re-assignment of ten (10) ministers to new ministerial portfolios;

5. Di discharge of five (5) Ministers.

6. Di nomination of seven (7) new ministers for onward transmission

to Senate for confirmation;

7. Di appointment of Shehu Dikko as Chairman of di National Sports

Commission;

8. Di appointment of Sunday Akin Dare as Special Adviser to di

President on Public Communication and Orientation and to begin work from di Ministry of Information and National Orientation

Who be Bianca Ojukwu?

Out of all di seven new ministers wey Tinubu nominate, e get one wey don dey cause tok-tok among Nigerians.

Dat na di nomination of Bianca Odinakachukwu Ojukwu, wey be wife of late Odumegwu Ojukwu.

No be say Bianca Ojukwu name small for Nigeria political space but her popularity stand out.

Dis na sake of who her late husband, Ikemba Chukuemeka Odumegwu Ojukwu be and di role wey im play for di evolution of politics for Nigeria di time wey im dey alive and di effect over di years.

Bianca Odinakachukwu Olivia Odumegwu-Ojukwu (née Onoh, na Nigerian politician, diplomat, lawyer, and businesswoman.

She be di wife of former Biafran President, Ikemba Chukuemeka Odumegwu Ojukwu.

Born on 5 August 1968 Bianca get many international beauty pageant titles.

She win Most Beautiful Girl in Nigeria for 1988 and Miss Africa.

And she popular pass as di first African to win Miss Intercontinental.

For December 2011, President Goodluck Ebele Jonathan appoint her Senior Special Assistant on Diaspora Affairs.

She bin serve as ambassador to Ghana and later become Nigeria Ambassador to di Kingdom of Spain for 2012.

She also be permanent representative to di United Nations World Tourism Organisation.

Bianca get so many tittles from her native land including di highest title wey dem dey give women for her region.

Biance late husband, Col Ojukwu bin die in di UK on 26 November 2011 afta one long illness, for age 78.

One of di major tins wey make di Ojukwu name remain green na im 1967 declaration of independence for Biafra wey bin cause civil war, wia more dan one million pipo bin die.

Since den,e become one ogbonge figure for Nigerian politics, e bin run twice as presidential candidate for di 2000s.

Col Ojukwu bin go exile afta Biafrans surrender for 1970, to return more dan ten years later, afta e authorities don officially pardon am.

Afta Ojukwu amnesty, e bin get full military honours for im funeral, wit military band wey play for im family home for Nnewi, Anambra state.

Bianca Ojukwu still dey kontinu wit her late husband legacy.

Source