Ghana Speaker suspend sitting of MPs until further notice sake of Supreme Court ruling ontop four Lawmakers matter

General view of di Parliament of Ghana during Turkish President Recep Tayyip Erdogan visit, for di capital Accra on March 01, 2016.

Getty Images
General view of di Parliament of Ghana during Turkish President Recep Tayyip Erdogan visit, for di capital Accra on March 01, 2016.

Speaker of di Ghana parliament don adjourn sitting for di house indefinitely.

Alban Sumana Kingsford Bagbin on Tuesday afta one rowdy session wia some lawmakers bin waka commot di chamber say di announcement dey necessary sake of di current crisis wey dey shele for di house.

Di speaker add say e bin don consult wit di leadership and now dey exercise im right of discretion to suspend parliament.

Standing order 59(1), say “di speaker in consultation wit leadership fit suspend meeting of di house indefinitely or for a period wey dey determined by di speaker, wit regard to di public interest and di exigencies of di state of affairs for di kontri,” Bagbin tok.

Earlier, di Parliament of Ghana bin tighten security ahead of lawmakers arrival for major sitting for di chambers.

Lawmakers wey dem bin declare dia seats vacant reach di chamber early to take position.

Dis dey come afta speaker of Parliament, Alban Sumana Kingsford Bagbin, on 17 October declare four parliamentary seats vacant.

Oga Bagbin declaration na based on say di current occupants don defect as dem file to contest di next elections on tickets wey dey different from di party wey bring dem come di Parliament.

On Friday 18 October, di Supreme court temporarily stop di speaker decision to declare di seats of four seats vacant.

Di court order for suspension of enforcement of Oga Bagbin ruling of 17 October, to allow di MPs to retain dia positions for di time being.

Meanwhile for one press statement wey one Deputy Marshall of Parliament Frederick Bawa sign, e explain say di aim of di measures na to fit guarantee di safety and security of di Speaker of Parliament, Alban Suman Bagbin, MPs, and staff.

Who be di law makers wey dey affected?

Di four MPs bin file to contest di the next parliamentary election as independent candidates.

Cynthia Mamle Morrison na di MP for Agona West, under di New Patriotic Party (NPP).

Kwadjo Asante for Suhum for Ghana Eastern Region also be MP under di New Patriotic Party (NPP) bifor im declare to run as independent candidate during di next election.

Peter Kwakye-Ackah na MP for Amenfi Central, for di National Democratic Congress (NDC).

Andrew Amoako Asiamah na MP for Fomena, e also be di Second Deputy Speaker, bifor dey elected as independent candidate but now don file to contest di next election on di ticket of di New Patriotic Party (NPP).

Security measures in place

As part of measures wey dey in place to guarantee di safety and security of di Rt Hon Speaker, MPs, and staff, Honourable Members respectfully dey requested to take note of di following, di statement tok:

  • “ALL MPs, staff, and members of di press go thoroughly dey screened bifor entry into di Chamber.
  • Bodyguards of MPs no go dey permitted for di Chamber.
  • “Vehicles no go dey allowed to park around di Grand Arena. d. MPs go dey dropped for di drop-off zones wey dey within di precincts of AICC,” di statement further tok.
  • Di Ghana Police Service go provide directions to di designated drop-off zone.
  • “MPs dey requested to wear dia parliamentary identification tags.
  • Access to di Chamber go be from 0800hrs.
  • Di public no go get access to di public gallery until further notice.

Wetin really happun

Di security measures follow one legal tussle between di parliamentarians over who go become di Minority afta di legal gbege.

Chief Justice Gertrude Torkornoo, bin cancel Oga Bagbin ruling afta e bin hear di application wey di New Patriotic Party (NPP) Members of Parliament file.

Di apex court decision for now don effectively suspend di suspend further action on di Speaker 17 October ruling pending further legal review and final determination.

Di court say di speaker ruling dey deprive di four constituencies of representation for Parliament.

E also point out say Oga Bagbin decision go likely lead to allegedly frustrate govment business for di Parliament.

“E go also sink di management of di country affairs into possible disruptions”, di court add.

E further add say, di declaration wey di Speaker make, raise real kwesion of constitutional interpretation and di application of di most fundamental and democratic rights of Ghanaians, wey be di right to dey represented and heard for Parliament through dia elected representatives.

Di court order both di speaker and di attorney general to submit dia statements within seven days to make happun quick resolve of di issue.

Bagbin bin grant one motion by di minority leader, Cassiel Ato Forson, to declare some four seats vacant.

Di Speaker note say di decision by di affected MPs to contest for di December 7, 2024, election as independents or on di ticket of one party wey different from di party wey dia ticket dey currently serve, dey against di Article 97 (g) and (h) of Ghana 1992 Constitution.

Na one MP Haruna Iddrisu bin file motion to call for constitutional provisions wey require MPs wey change political parties or run as independents to comot dia seats.

Bagbin bin argue say di provision dey key to maintain party loyalty within Parliament.

Di decision bin cause quick backlash from di parliamentary majority, di New Patriotic Party. Wey later cause boycott of parliamentary proceedings to protest against wetin dem say na unconstitutional ruling wey favour di opposition National Democratic Congress (NDC).

Ghana general elections go hold fo 7 December 2024.

Na den di presidential and parliamentary contests go happun to determine di kontri next president and all 275 members of Parliament.

Ghana holds general elections every four years, typically on December 7. These elections determine the president and all 275 members of Parliament.

Source