Why Actors Guild of Nigeria suspend actress Halima Abubakar

Di Actors Guild of Nigeria (AGN) don suspend Nollywood actress Halima Abubakar until further notice.

AGN wey be di join-bodi of actors for di kontri for one statement say dia reason na sake of di report of di investigation wey dem conduct on di actress.

Dem say dia decision dey come “afta di thorough investigative report by di special Secret Investigation Panel wey dem set up to conduct internal underground secret investigation into di activities of some blog/bloggers”.

“Afta two years of painstaking investigations, di Panel find out say Miss Halima Abubakar bin dey behind all di slandering information of our members, associates and patrons, especially news of extra marital affairs linked wit highly placed individual for di society wey dey come from di industry,” di statement tok.

Miss Abubakar neva react to dis allegations and BBC News Pidgin dey try get her team to react to am.

Dem say Miss Abubakar go dey on indefinite suspension from di AGN and face di National Disciplinary Committee to determine her full punishment.

AGN say during dis suspension, she no dey permitted to participate for any AGN or filming activities.

“Di National/State Chapter Taskforce don dey duly mandated to monitor di compliance of di above order as violations of di suspension rules fit lead to further disciplinary actions.

On behalf of di Actors Guild of Nigeria, I commend di professional and incisive work wey members of di secret investigative panel do,” AGN tok.

AGN say di secret panel dey investigate some female members wey dey on di watch-list, “especially for di recent release of names purported to get dealings wit di Senate President”.

Source