Turkish cleric wey dem accuse of failed 2016 coup against President Recep Tayyip Erdogan don die

Fethullah Gulen

Getty Images

Fethullah Gulen, di Turkish cleric wey dem accuse as di mastermind of one bloody attempted coup for 2016, don die for age 83, di Turkish foreign minister don confam.

Di cleric, wey bin dey live for self-imposed exile for di US, die afta dem admit am to one Pennsylvania hospital, according to reports of Turkish tori pipo.

Sometimes dem dey describe am as Turkey second most powerful man, Gulen na di spiritual leader of di Gulen movement, one powerful Islamic community wit followers for Turkey and worldwide.

Turkey President Recep Tayyip Erdogan bin blame di Gulen movement for di 2016 attempt coup, accusations wey Gulen deny.

Wen e bin tok for one press conference for Ankara, Foreign Minister Hakan Fidan tok say intelligence sources don confam Gulen death, describe am as di leader of one “dark organisation”.

Gulen bin rise to prominence by arguing say young pipo for Turkey bin don lost dia way and education na di best response.

Im movement – wey dey popular for Turkey as Hizmet or “service” – first gain foothold running schools, and e bin go on to open educational institutions across Turkey and around di world.

As di movement bin dey grow, followers bin expand into business and begin take jobs inside di goment and military.

Hizmet na once ally of Erdogan, but di Turkish president turn on di movement for 2013, and vow to shut down hundreds of dia schools and clear di goment of Gulenists, wey e bin call “state within a state”.

Gulen-allied police officers bin chop accuse say dem dey carry out raids against Erdogan allies, and di Turkish govment formally declare Hizmet terrorist organisation for May 2016.

Turkish solders stand wit guns at Taksim square as pipo react for Istanbul on July 16, 2016.

Getty Images
For 2016, soldiers dey seen on di streets of Istanbul during di attempted coup say authorities blame on Gulen movement

Two months later, one faction of di Turkish army attempt to overthrow Erdogan. Dem say di aim na to protect democracy from di authoritarian Turkish president.

For one violent night, TV stations bin dey raided by soldiers, pipo bin hear explosions for Istanbul and Ankara, protesters dey shot and di parliament and presidential buildings dey fired upon.

But di coup fail to gain support from di public or di wider military and di army faction wey lead am dey forced to surrender.

Di goment bin blame Gulen, but e deny di claims and condemn di coup.

Thousands of arrests bin follow, including almost one third of di military top brass as well as thousands of officials and bureaucrats.

Gulen for im home for interview by di BBC

BBC
Gulen avoided any rhetoric wey fit further inflame Turkish tensions during one 2014 BBC News interview

By dat time, Gulen don already dey live for self-imposed exile for di US, wia e bin move for 1999.

Turkey bin request im extradition to face trial but di US don tok say dem need see evidence of im involvement for di coup first. E bin remain for di US until e die.

BBC News bin interview Gulen for im remote Pennsylvania estate for 2014.

Di cleric bin prove difficult throughout di interview and dodge kwesion on who e go vote for di upcoming Turkish elections.

“If I fit say anytin to pipo I fit say pipo suppose vote for those wey dey respectful to democracy, rule of law, wey get on well wit pipo,” e tok.

Source