‘Dem bin threaten me many times’ – Rape, torture and murder allegations hit student union

Ivorian security forces bin patrol one student campus for Cocody, Abidjan, on 7 October.

AFP
Raids bin happun earlier this month

Ivory Coast goment don shut down all student unions for di kontri.

Di goment make dis announcement afta di killing of two students, wey dem blame on di powerful Student and School Federation (Fesci).

Police don arrest several Fesci members in connection wit di murders of Khalifa Diomandé and Zigui Mars Aubin Déagoué, wey happun for August and September.

Police during dia investigation for Félix-Houphouët-Boigny University for di main city of Abidjan, see one underground tunnel dem dey use torture pipo and one one brothel, authorities tok.

Students tell BBC say na open secret say Fesci dey operate di two illegal sites but say evribodi dey fear to speak out.

“You no go believe say you dey university for kontri wey dey organised,” one former student wey no want make im name dey mentioned tok.

“Fesci bin threaten me many times, dem try to rape me,” she tell BBC. “My boyfriend bin try stand up for me, and dem beat am up,” she claim. On oda occasions, she say she gatz pay Fesci members to leave her alone.

She say she still dey traumatised, and neva set leg on di campus since she drop out afta her ordeal eight years ago.

“I no know how e last so long but now I feel relieved for di victims,” she add.

Di students say extortion na common tin.

“I suppose to pay $100 (£77) per month for my room, “Jose Aristide explain, “but dem bin force me to pay $250 per month.

“I no get any option. Evribodi dey fear dem”

Charles Blé Goudé and Guillaume Soro sit and talk at an event in 2007.

AFP
Former Fesci leaders include politicians Charles Blé Goudé and Guillaume Soro

On Thursday, Ivory Coast Security Council say dem carry out series of raids for Abidjan and di central city of Bouaké, wia dem seize more dan 100 machetes and grenades.

Dem also see and expel 5,000 undeclared residents for university campuses across Abidjan, Bouaké and Daloa.

Wen goment announce di student union ban dat same day, pipo bin celebrate.

One lecturer tell BBC say im welcome di ban – e say im hope e go bring some peace come di campuses.

Originally set up for di 1990s as a student body, Fesci soon become anti-goment protest group, and for long, pipo don suspect say e dey involved in organised crime.

E don also serve as springboard into politics for some.

Former Fesci leaders include Guillaume Soro – one rebel leader wey turn prime minister, and Charles Blé Goudé – one former youth minister wey chop accuse of massive human rights violations during post-election violence wey happun ten years ago, but dem later declare am innocent.

Source