Chidimma Adetshina emerge Miss Universe Nigeria 2024

Chidimma Adetshina don emerge winner of Miss Universe Nigeria 2024.

Chidimma wey be Miss Taraba beat 24 oda contestants to win di pageant wey hold for Lagos, Nigeria commercial city.

She bin suppose contest for di Miss Universe for South Africa but many tins happun wey lead to her rejection.

Dis contest bin generate plenty excitement plus gbas gbos between South Africans and Nigerian plus including dia supporters all over di world.

Di centre of dis gbaos gbos na Chidimma Adetshina, di Nigerian-South Africa beauty queen wey bin face criticism for Soth Africa wen she bin dey contest for Miss Universe South Africa.

As tins be now, Chidimma now go go represent Nigeria for di Miss Universe 2024 pageant for Mexico in November.

“I feel amazing. Dis crown no be just for beauty, but a call for action, and dat na unity,” she tok afta dem wear her di crown.

Nigeria minister of Arts and Culture Hannatu Musawa follow for pipo wey present flower bouquet to di winner.

She also promise to support di winner to make sure say she make Nigeria proud.

South Africans criticise Chidimma

South Africans bin drag Chidimma, begin question her citizenship.

Some pipo for di kontri bin para say she no fit reperesent dem becos she no from di kontri.

Initially, Chidimma bin qualify as contestant becos she be citizen of South Africa by birth.

But afta plenty dragging, di South Africa Home Office say her citizenship na case of stolen identity. Dem still neva tok who identity her parents carry give her.

Chidimma papa na Nigerian man wey marry Mozambique woman.

Afta she pull out of di South Africa beauty contest, Miss Universe Nigeria pageant invite her to come join di contest for her father land.

Chidimma come represent Taraba state for di Miss Universe Nigeria contest.

As di hour for di grand finale of Miss Universe Nigeria dey near, tori be say pipo for South Africa social media dey vote against Chidimma in favour of Miss Kwara, Ufa Dania.

Fan voting na part of decision making process wey di organisers of di pegeantry introduce to help determine di contestant wey go make am as part of di top 10 contestants.

Anybody dey free to vote as many time as dem like, for di contestant wey dem like.

Di top three contestant wey get di highest number of fan votes out of all di contestants, go get fast track spot to top 10.

Ufa votes shoot go up as South Africans for X and Facebook rally support for her.

Di 25 years-old Ufa na di first ever full figured contestant for di history of Miss Universe Nigeria.

Her appearance alone don draw pipo attention, for competition wey bin originally for slim pipo.

Dis year Miss Universe competition tie serious wrapper sake of Chidimma.

Wetin be Miss Universe?

Di Miss Universe contest na international beauty contest wey dem dey do evri year.

Di purpose of di beauty pageantry na to celebrate young women from around di world, wey come from all cultures, backgrounds, and religions.

E dey empower women by providing platform for dem to share dia tori, showcase dia talents, plus advocate for causes wey dey close to dia heart.

Di winner of di Miss Universe title go serve as global ambassador wey go work on humanitarian projects plus promote orishirishi social causes.

Participants for di contest dey come from different kontris all over di world, wia dem for don first participate to win di title for dia kontri, like Miss Universe Nigeria or Miss Universe South Africa.

Dem dey compete for various segments, including personal statements, in-depth interviews, evening gown, and swimwear.

Di most recent Miss Universe Nigeria, wey dem crown for 2023, na Ugochi Ihezue wey be Miss Imo dat year, while di one for Miss Universe International na Sheynnis Palacios from Nicaragua.

Source