Wetin di UK online permanent visa dey all about?

Black women dey wear face mask and health case workers clth

Getty Images

Di United Kingdom don announce say from next year, dem no go dey need biometric residence card to prove say you be permanent resident for di kontri.

Dis na sake of dia new programme wey be online immigration status wey dem dey call eVisa.

Di eVisa na online record of your immigration status.

According to di UK goment, “for future, you go fit use eVisa take travel enta UK, you no go need physical document except your current passport”.

But dem add say, “till di end of 2024 you go need to continue dey carry physical document wen you travel if you get one”.

Wetin be dis eVisa

eVisa na online record wey go carry pesin immigration record.

E dey part of di digital immigration system wey di UK Visas and Immigration (UKVI) dey develop.

Di eVisa go replace Biometric residence permits (BRP), passport endorsements like indefinite leave to enta wet stamps and vignette sticker like entry clearance.

Di BRPs na wetin pesin wey dey apply to enta UK for ova six months, increase visa to ova six months, apply to settle for di UK, transfer visa go new passport, dey get

E dey help foreigner for di UK to identify diasef, prove right to study and right to any public service wey dem fit get.

To fit get to am pesin need to create UKVI account and register wit your current passport details so e go link to your passport.

But from 31 December 2024 all di new BRps go expire and na eVisa go dey run all dat work.

UK visa graphic

Getty Images

Why UK dey settle on dis eVisa of a tin

According to di UK goment website, eVisa don dey shared since 2018.

Dem reveal say dem don give millions di eVisa online, for instance wit di EU Settlement Scheme.

Di visa make am easier to prove your status for di UK border and share di status wit third parties like employers and landlords to prove pesin right to live and work for di UK.

How pesin fit get eVisa and UKVI account

For pipo wey get di BRPs wey dey expire on 31 December 2024, dem go fit create UKVI account wey dem go use take access dia eVisa.

Di creation of di UKVi account suppose happun bifor di BRP expire but di BRP sha go still dey necessary for use if di pesin dey travel internationally till e expire.

For pipo wey don lost dia BRP, passport or visa application reference number go work to create di UKVI account,.

Afta di creation of UKVI account, pesin wey get permission to stay for UK go fit sign into wetin dem call di view and prove service and na for dia dem go fit access dia eVisa.

Wetin dem dey use UKVI account do?

Di UKVI account dey help pesin to see details of di eVisa online. Dis na tins like which kain permissions pesin get, wen e dey expire and wetin be di conditions for your stay.

You fit put tins like your contact information for di UKVI.

Your eVisa go dey linked to your passport for di UKVI account wey mean say di information for di passport wey dey di account gatz dey current.

Pesin fit also share immigration status information give employers or landlords as dem need am.

E dey work wit share code wey dey limited in how long dem fit view pesin immigration status informate.

Wit di UKVI, di foreign office go also fit share relevant informate about your immigration automatically wit some goment departments and public authorities.

Dis mean say di pesin no need to go online all di time to prove dia immigration.

Source