Number of wanted pipo for Sierra Leone drop to 29 afta ‘attempted coup’

Authorities for Sierra Leone don declare some pipo wanted in connection wit last Sunday attempted coup.

Di goment of Sierra Leone ministry of information and civic education make di announcement on Tuesday wia dem declare 34 pipo wanted.

Dis na di latst afta goment call di katakata wey happun on Sunday wia gunmen attack goment institutions for di kontri capital Freetown, as attempted coup.

Di kontri information minister say di gunmen bin try to “subvert and overthrow” di goment on Sunday.

Dem attack military barracks and prison, free 2,000 prisoners, authorities tok.

At least 19 pipo including security forces and one civilian, die for di violence.

Information Minister Chernoh Bah tok on Tuesday say: “Di incident na failed attempted coup. Di plan na to illegally sabotage and overthrow democratically elected goment,”

“Di attempt fail, and plenty of di leaders either dey police or dem dey run. We go try capture dem and bring dem to full force of di laws of Sierra Leone.”

Di political situation for Sierra Leone don dey tense since June, wen President Bio win re-election – narrowly missing out on di need to do run-off.

In August, some pipo including some high ranking sojas bin chop arrest and accuse of plotting a coup against di president.

International observers don condemn di inconsistencies and lack of transparency for di count, as well as acts of violence and intimidation.

Road empty as Sierra Leone impose curfew

Getty Images

Major coups for Sierra Leone

History of Sierra Leone politics show say e no stable from way back and coup no be new tin.

Di kontri don experience several coups plus military regimes. Some of dem include:

Double coup for 1967

Di first time wey Sierra Leone experience coup afta dia independence from Britain for 1961, na for 1967.

On St Patrick Day 1967 Sierra Leone pipo go to elect new parliament.

Four days afta di election, on 21 March, Brigadier David Lansana, head of Sierra Leone army, seize power from Prime Minister Siaka Stevens.

But two days afta Lansana coup, some group senior army officers overthrow am on 23 March.

1991 Sierra Leone Civil War begin

Sierra Leonean civil war begin for March 1991, wen Revolutionary United Front (RUF) from Liberia enta Sierra Leone, to overthrow di goment of di All Peoples Congress (APC).

RUF accuse APC say e too corrupt and e don too stay for power since 1967.

Foday Sankoh, one corporal of Sierra Leone Army wey bin go prison for 1971 for attempted coup against APC lead di RUF rebels wey figt very brutal battles.

From 1991 RUF fight brutal fight to overthrow different goment both military and elected civilian regimes.

As di war begin, di kontri no see peace and political instability consume am.

1992 coup

Di 1992 Sierra Leone coup d’état happun against President Joseph Saidu Momoh.

One group of young military officers wey 25-year-old Captain Valentine Strasser lead, overthrow Momoh on 29 April 1992.

Dem put Momoh for helicopter, send am go exile to Guinea.

Strasser through im political party, National Provisional Ruling Council (NPRC) rule di kontri until im deputy, Brigadier Julius Maada Bio overthrow am for 1996.

1997 coup

Wen di 1997 coup occur on 25 May, no serious sign of trouble bin show for di capital Freetown.

Civilian president Ahmed Tejan Kabbah bin sign peace deal wit RUF, international investors don begin return to di kontri.

Early momo on Sunday May 25, Corporal Tamba Gobrie announce say dem don overthrow Kabbah, come impose curfew.

Dis 1997 coup na di last time wey di kontri experience military overthrow of goment, as since afta am, Sierra Leone don dey under civilian rule reach now.

Source