Galatasaray vs Man United, prediction, team news and time

Galatasaray vs Man United

BBC

Manchester United boss Erik ten Hag dey confident say im players fit handle Galatasaray hot atmosphere and beat dem on Wednesday for dia important Champions League Group A match.

Di Red Devils know for dia mind say if dem lose for Istanbul dem no go fit reach di knockout stage.

Dis match dey come 30 years afta United first trip to Galatasaray.

“We know say we fit [win away for Europe] we dey confident,” Ten Hag tok.

“Di last games away from home for di league bin dey for very hostile environments. We bin play very well. We bin dey very calm and composed.”

Those games see United register win for Fulham and Everton, and di 3-2 defeat to Galatasaray for Old Trafford on October 3 na result wey United dey eager to make up for dis week.

Last year, dis team for Barcelona [for Europa League do well], so we know how to deal with dis kain tin and I dey sure say na confident team go dey pitch,” Ten Hag add.

Bayern Munich don reach di Champions League knockout stage as Group A winners wit two matches to spare afta dem beat Galatasaray.

But Manchester United, FC Copenhagen and Galatasaray all of dem still fit reach di last 16.

But United, go comot if dem lose to Galatasaray on Wednesday.

And even den sef, di Red Devils’ fate no dey dia own hands – dia two wins from dia final two matches no go dey enough for Erik ten Hag side if FC Copenhagen also win dia two games too.

Galatasaray vs Man United predictions

Galatasaray vs Man United

Getty Images
Erik Ten Hag bin lose 3-2 to Galatasaray wen di two teams face each oda for Old Trafford

‘’Dis Champions league game go dey highly-charged sake of all di intimidation fron di home fans’’. Football sabi pesin Joshua Adetunji tok.

‘’Manchester United dey go very difficult ground, di Rams Global stadium, wey be Galatasaray home ground’’. Adetunji add.

‘’Galatasaray dey a good place to qualify afta dem win di reverse fixture 3-2 for Old Trafford and United know say dem no go fit reach di knockout phase if dem lose tonight for Turkey’’.

‘’I believe say di game go end for draw’’.

Prediction- 2-2

Galatasaray vs Man United possible line up

Galatasaray: Muslera; Boey, Ayhan, Bardakçı, Angelinho; Torreira, N’Dombélé; Barış Yılmaz, Mertens, Zaha; Mauro Icardi

Players wey no go play sake of injury: Sánchez

Player wey fit no play: none

Players wey go miss next match if dem collect card: Sérgio Oliveira

Man United: Onana; Wan-Bissaka, Lindelöf, Maguire, Shaw; Mainoo, McTominay; Pellistri, Bruno Fernandes, Garnacho; Martial

Players wey no go play sake of injury: Martínez, Casemiro, Eriksen, Mount, Evans, Malacia

Player wey fit no play: Højlund, Antony

Suspension: Rashford

Di game go start 6:45pm west African time.

Source