How WAEC dey mark students examination paper?

WAEC 2024

Getty Images

Di 2024 West African senior school certificate exam don start for Nigeria.

Millions of secondary students go sit for dis year WAEC certificate exam across di kontri.

Na WAEC results wey universities and polytechnics dey use to determine who dem go admit for dia school for parts of West Africa.

Dis na eviritin you need to know about dis ogbonge exam.

WAEC officials dey mark candidates scripts?

No be WAEC dey mark students examination paper, na examiners WAEC dey appoint to mark di scripts.

So who be dis examiners?

Dis examiners na sabi pipo for di education sector wey know classroom work well-well.

To ensure say mago-mago no dey for di grading system, WAEC dey set up Committee of experts wey go come up wit di marking guide.

Na dem go drill all di appointed examiners well-well on all aspects of di marking scheme for one marking exercise wey dem dey call co-ordination.

Even wen di actual marking start, dem no dey leave di examiners on dia own.

Dem dey organise dem into small groups, each of dem go dey supervised by one highly experienced examiner wey be di Team Leader.

Na di Team Leader dey check and vets di group members’ marking progressively to make sure say dem dey follow di guidelines.

Di Team Leaders themselves dey supervised by more experienced examiners wey dem dey call Chief Examiners.

Wen dem don mark finish, WAEC go still employ anoda group of pipo those ones dem dey call dem Checkers.

Di main role of Checkers na to make sure say all di marks wey di examiners give dem record am correctly and dem transfer am to di right score sheets.

WAEC no dey reveal di identity of di examiners wey dem dey use to mark di exam papers.

Which grades WAEC dey use?

WAEC grade for each exam subject na from A to F.

A mean excellent while F mean say di candidate fail based on dia performance for each subject.

Student go know how dem perform for dia exams wen WAEC publish di result.

Candidates dey required to enter and sit for a minimum of eight (8) and a maximum of nine (9) subjects.

Which officials WAEC dey use to conduct exam?

Na three categories of officials WAEC dey use: supervisors, invigilators and inspectors.

Supervisors na teachers wey dey nominated by various State Ministries of Education.

Na dem dey dey conduct di exams for various centres. Dia work na to collect question papers from di students and return answer scripts to di custodian centres.

Usually di Invigilators na teaching staff wey di school principals nominate to assist di supervisors for di centres.

While inspectors na WAEC staff members wey dey go from one centre to anoda wen di exam dey in progress.

List of tins wey be exam malpractice for WAEC

  • Candidates wey carry books or cribs enta examination hall na offense
  • To insult or assault any examination official na offense
  • To swap scripts inside examination hall na offense
  • To replace your answer scripts wit anoda one during or afta di examination na offense
  • Impersonation dis one mean to write exam for pesin na offense
  • To take part in mass or organised cheating for exam hall na offense
  • Odas dey inside di Council Regulations & Syllabuses dem.

Wetin be WAEC?

Di West African Examination Council, na international exam for senior secondary school student wey dey happun every year.

Kontris wey dem write WAEC na, Gambia, Ghana, Liberia, Nigeria and Sierra Leone.

Na for 1952 dem establish am. According to information on top dia website, di vision of di West African Examinations Council na to be a world-class examining body wey dey add value to di educational goals of im stakeholders.

WAEC na West Africa ogbonge examining board wey dey established by law.

Dia work na to set, conduct di examinations and to award certificates wey dey comparable to dat of equivalent examining authorities internationally for di English-speaking West African kontris,.

Source