Terry Waya, BBNaija Kiddwaya papa speak about im son game and relationship with Erica inside Big Brother Naija house

Terry Waya, di papa of Kiddwaya, Big Brother Naija season 5 housemate don open up about im son stay for inside di house.

For inside interview with Ovation Dele Momodu ontop Instagram, e open up say initially e bin no know wetin di show dey about and e no quick give im support for im son to go for di show.

“Normally na im dey do everything for everybody, na im dey pay school fees, for im brothers, I go send am go London, na im dey handle everything, I get up dey find am, I come ask wia e dey, dem say e go Lagos, my friend arrange aircraft to carry am go Lagos, I no even know.

“Wen e come back I tell am to go isolate yourself for 10 days or 2 weeks, afta some time e come tell me say e bin dey want to enta Big Brother, di way I look am eh, e know say e no fit continue di conversation, na so e comot.

“All my friends come dey call me say na wetin e wan do be dat but I no want anybody to tok to me about am. He comot without my permission”. Na so Waya tok.

https://www.instagram.com/p/CEaADBNjQ2Y/

Waya say Kiddwaya come dey send message through im uncles to im papa for wia e dey isolation before dem enta Biggie house to get permission from im papa.

“Wen e get dia dem isolate dem. my brodas tell me say e call dem from wia dem isolate am say e dey worried and e say if e no get my blessing e no go go, dem come dey beg me to give am my blessing.

“I come look am say at im age my papa no know wia I dey, I come say if na wetin e wan do, make e do am.” Im add

Waya add say since im son enta di house, di support e don get from Nigerians dey sweet im belle well-well.

“Di journey don dey amazing so far, so much support from Nigerians. di way some Nigerians dey appreciate am based on imsef and not because of who im papa be, I appreciate Nigerians so much”

“Sometimes tori go come out say im papa dey try buy support and all dat, na lie, na di support of Nigerians na im dey keep am dia.”

Terry Waya say Kidd get two tins wey e dey passionate about, di plight of young women wey dey experience rape and pipo wey dey IDP camp.

“I really want am to win am so e go fit put di resources to good use. But even if e no win am, just di support Nigerians don show am, I dey really very impressed.”

Wen Momodu ask am about Erica, e laugh come say:

“As you know me, I cut across all Nigeria, anywhere I go I am at home, e no get place for Nigeria wia I no get best friends, so anywhere my children decide to set up home, dem get my blessings, we all na one, e no mata which language all culture we be one, whoever he choose all I get to do as papa na to support am.” Waya tok.