Di disappearance of dis six-year-old girl dey shake South Africa

Police for South Africa dey question four pipo ova di disappearance of one six-year-old girl wey go missing two weeks ago.

Di search for Joslin Smith don shake di kontri since she disappear outside her house for Saldanha Bay, near Cape Town.

On Monday, 300 naval officers join rescuers from Cape Town, one dog unit and drones for di desperate search.

Authorities dey question two men and two women ova di disappearance.

“We dey hope say as di investigation continue, we go sabi her whereabouts or wetin happun to her, “Brig Novela Potelwa, police tok-tok pesin for South Africa Western Cape province tok.

Pikin dey miss every five hours for South Africa, but dem dey later find most of dem.

On Saturday, investigators see cloth wey get blood for one open field for di area wia Joslin take disappear on 19 February.

Community members bin search canals and pits for days afta di girl disappear.

Saldanha Bay Mayor, André Truter tok say pipo wey dey para dey raid pipo houses and dey harass neighbours in search of di child.

Police don offer 100,000 rand ($5,200; £4,100) reward to anyone wey get information on her whereabouts.

Her mama boyfriend, Jacquin Appollis, na im she bin dey wit wen she miss.

E no fit account for her whereabouts, police tok. E don deny involvement for her disappearance.

Joslin mama don before now tell local publication, The Daily Voice say she no dey give up hope.

“My motherly instincts dey tell me say my daughter still dey alive and for dis area. We go find her, I go use leg waka to find her. I go look every place, I go do am by myself if I get to.”

Some community members bin accuse di couple say dem get hand for dia daughter disappearance, accuse wey both of dem deny.

Authorities don move dem go safehouse for dia own safety.

Brig Potelwa tok say make di public no spread false information about Joslin disappearance or share recordings from di search operations.

“Dis fit negatively impact di investigation. Di primary focus of di coordinated efforts na to find Joslin or wetin happun to her.”

Source