How Japan state burial for Shinzo Abe waka

Guests during di burial

EPA
More dan 4,500 pipo attend including hundreds of foreign guests

Thousands of pipo gada for Tokyo, Japan capital to bury di former prime minister, Shinzo Abe wey gunman shoot die for one election rally for July.

Security dey tight as more dan 700 foreign guests fly in for di event, including about 50 current or former state leaders.

Thousands of pipo bin line up to lay flowers but for few kilometres away, thousands of odas gada to protest.

Shinzo Abe, Japanese former Prime Minister

Getty Images
Pipo dey leave flowers and pay dia respects to former Japanese prime minister Shinzo Abe
Shinzo Abe, Japanese former Prime Minister

Getty Images
Akie Abe, widow of Shinzo Abe, bow during di state funeral

Di decision wey Japan take to give oga Abe state funeral dey controversial, with more dan half di population wey tok say dem no support am.

Many pipo dey vex say di goment spend around twelve (12) million dollars on di event, without getting di approval of parliament.

How di funeral happun

Shinzo Abe widow carry ashes into state funeral
The British Broadcasting Corporation

About 4,300 guests attend di funeral, wey dem do for di Nippon Budokan – one famous sports and concert arena inside central Tokyo.

Di ceremony begin around 14:00 local time (05:00 GMT), but dem invite members of di public to lay flowers and oda tributes for some stands outside from 10:00.

Up to 1,000 sojas na im perform ceremonial duties for di ceremony.

One military honour guard fire 19 blank rounds from one cannon to salute Abe.

Shinzo Abe: Cannons fire 19-gun salute for slain ex-PM
The British Broadcasting Corporation

Why Abe funeral dey so significant?

Shinzo Abe, Japanese former Prime Minister

BBC

Even as world leaders gada for Shinzo Abe funeral – many pipo for im own kontri dey protest against state funeral for am.

According to opinion polls, Abe no ever dey popular in a big way but na only few pipo na im go deny say e bring stability and security to di kontri.

So di decision to hold state funeral for am na also reflection of im stature.

No-one don serve longer for di prime minister office dan Abe and, arguably, no oda post-war politician get dis kind impact on Japan position for di world.

Experts say Abe dey ahead of im time.

“E understand di changing balance of power. Say a rising China go, of course, twist di balance of power and reshape di order for di region.

“So, e wan to take leadership,” professor Kazuto Suzuki, one political scientist and former Abe advisor bin tok.

World leaders wey gada to pay tribute to Abe

Shinzo Abe, Japanese former Prime Minister

EPA
US Vice President Kamala Harris

Dignitaries wey attend di funeral of Shinzo Abe, Japan former prime minister, include; 

  • US Vice President Kamala Harris, 
  • India PM Narendra Modi, 
  • Singapore  Prime Minister Lee Hsien Loong, 
  • Australian Prime Minister Anthony Albanese, 
  • Vietnamese President Nguyen Xuan Phuc
  • South Korean Prime Minister Han Duck-soo
  • Philippines Vice President Sara Duterte-Carpio
  • Indonesia Vice President Ma’ruf Amin, and 
  • European Council President Charles Michel.

Meanwhile di office of Prime Minister Fumio Kishida tweet pictures of im meetings from Monday and Tuesday morning.

Wetin happun to Shinzo Abe?

Shinzo Abe

Getty Images

Gunman assasinate di former prime minister on 8 July 2022 as im dey give one speech for im party for one campaign rally inside di city of Nara for Japan west.

One man with homemade gun shoot Abe from close range.

Di man tok afterwards say e bin target Abe for im promotion of and connections to one controversial church.

Di killing shock di world because political violence and violent crime in general no common for Japan.

Politicians often dey travel around with small security but authorities acknowledge say “undeniable” security flaws contribute to di assassination.

Why some pipo dey protest as odas dey Mourn Abe?

Outside di arena wia Abe funeral bin dey go on, thousands of pipo bin line up to lay flowers and pay dia respects.

Shinzo Abe, Japanese former Prime Minister

EPA
One woman wey dress in black and wear veil dey pray for one altar for Abe
Shinzo Abe, Japanese former Prime Minister

EPA
Pipo gatz go through metal detectors and dem go check dia bags first todey able to access di areas.
Shinzo Abe, Japanese former Prime Minister

EPA
Pipo gada early in di morning to leave flowers for Abe

Few kilometres away, thousands more gada to express dia anger ontop why Abe dey get di very rare honour of a state funeral.

Ogbonge security bin dey around di Budokan arena – as dozens of VIP and dignitaries in long motorcades land for di ceremony.

Around 60% of pipo say dem no support di state funeral.

Many dey vex say di goment dey spend around $12m of tax payers money on di event, without even gaining di approval of parliament.

Shinzo Abe, Japanese former Prime Minister

Getty Images
Protesters say di ballooning costs of di event dem for use am for more pressing economic goals
Shinzo Abe, Japanese former Prime Minister

Getty Images
Crowd hold up banner protesting di state funeral outside di Nippon Budokan for Tokyo