Pat Ugwu video: Nollywood actress Instagram twerking dance of wey show her bumbum and naked bodi for IG live vex some fans

Twerking dance steps wey Nollywood actress Pat Ugwu throw almost naked for her Instagram Live no go down well wit some fans.

Pat Ugwu na one of di many Nigerian actress dem wey dey always post naked foto and videos wey dey make pipo tok .

Latest tori be say di actress strip to her underwear as she twerks for her fans on Wednesday for di latest Instagram Live wey di Nollowood star do to show her followers another side of her.

But e no go down well wit all di fans, e don even cause controversy again.

Inside di video wey BBC Pidgin see, Pat dey rock wit some kain skimpy underwear as she twerk inside her room during di Instagram Live.

Tori be say no be today wey di actress don begin expose herself everi now and then for social media.

Almost a year ago ,Pat Ugwu share naked video of herself dancing wey later appear on many porn sites.

Dis Nollywood actress don declare her sef as di CEO of bumbum.

For one old interview wit one Nigerian local media, she say “You all know say my selling point, na my ‘Ikebe’

https://www.instagram.com/tv/B_0I2pAnH96/