‘I bin ghost am but begin chase am back wen she bone me’ – Zahara partner tok for singer memorial

Zahara

Getty Images

Na mixture of sadness, tears, music and humour as friends and family of late Bulewa Mkutukana wey pipo sabi as Zahara gada to tell her bye-bye for memorial service.

Plenti dignitaries bin come out to speak and sing in celebration of di life and times of Zahara.

Her partner, Mpho Xaba, bin reveal di tori of how dem meet wen im bin dey bad space for im life.

E say: “You bin tok say you go tok dis tin for our wedding, say I bin ghost you three times. Den she come leave me waka and na so me I start my chasing as di table turn”.

E add say e bin like to dey send am love messages for di course of dia relationship, but she bin complain say e dey too long so e come dey send am as voice note.

On di occasion of her memorial e use am read out wetin im call im last love letter to am.

Representative of di music community, Hepta Mailula bin tok for im speech about Zahara say, “di music sector bin dey worry say wen we go get anoda Brenda Fassie and she come uniquely from Brenda Fassie and rep di needs well.”

South African television presenter, Somizi Mhlongo tok about how e meet am and also how imself and di community take fail am.

E say: “E sure me say 80% of you neva follow Zahara tok for months now. And yet we carry ourselves from wia we dey come hia cos she don go. Look as I dey tanda for here now as if I bin dey all through, but I bin no dey.

“Di biggest lesson wey I don learn be say neva make joke about sombodi else downfall, if you no fit help, shut up!”

Singers like Judith Sephuma, Brenda Mtambo and Nomcebo Zikode including one member of di South African National Assembly, Ringo Madlingozi na part of di performers wey grace di memorial.

Family of late South African singer Zahara speak about her last moments

South African singer and songwriter, Zahara, dey perform for di Cape Town International Jazz Festival on March 31, 2012, for Cape Town.

AFP
Zahara get ogbonge fan base across Africa

Di family of late South African music icon Bulewa Mkutukana wey pipo sabi as Zahara don speak about her last moments before her death.

Di kontri Culture Minister Zizi Kodwa bin announce di death of di popular Afrobeat singer on Tuesday, 12 December 2023.

She die at di age of 36.

For one statement on Zahara Instagram post, her family tok say: “Surrounded by family and loved ones, Zahara comot dis world on Monday, 11 December 2023. She be pure delight and pure heart for dis world.”

Her family describe her as a beacon of hope, a gift plus blessing to dem and many pipo around di world.

Her fans dey grieve as dem share fond memories of her on social media.

Di family for dia tribute say make pipo remember Zahara not wit sorrow but wit stories of healing, joy, kindness and inspiration, she bring to pipo through her life and music.

Last month, di family confam say she dey admitted for hospital and ask South Africans to remember di musician for dia prayers.

Di culture minister tok say she dey admitted for hospital, reportedly wit liver complications and di goment don dey assist di family “for some time”.

Di singer win fame for 2011 wit her album Loliwe, wey pipo across Africa love.

For 2019, Zahara bin open up about her battle wit alcohol addiction.

Zahara: Violence against women in South Africa ‘na pandemic’
The British Broadcasting Corporation

Zahara, wey release five albums, win dozens of awards both local and international.

For 2020, dem name her for di BBC 100 Women list.

Di songwriter dey also use her platform to speak out about violence against women for South Africa, sometin she reveal say bin happun to her.

For one interview wit one local radio last year, Zahara tok say her music no be for recognition but to bring comfort to broken souls wey need healing.

Profile: Zahara

Dem born Bulelwa Mkutukana AKA Zahara for 9 November for East London, South Africa.

She be multi-platinum, award-wining singer and song writer.

According to her Instagram profile, she teach herself to play di guitar – one musical instrument.

Di ogbonge singer begin sing at a very young age. She begin sing for streets of East London before one music record label sign her, dat na how her journey to di music industry take start.

Pipo don describe her music as a mixture of various musical styles.

For July 2014, dem murder Zahara young brother Mbuyoiseli Mkutukana. She tok say im death bin make her enta depression.

Zahara release her first album Lowlie for 2011 and e become instant success. She don release more albums afta dat one.

Di singer also don win several awards wey include Best female artist of di year, album of di year, among odas.

Source