Who be Bobrisky and why e dey di middle of controversy?

From cross dressing, to fame, den to prison – all dis fit sum up di journey of ogbonge socialite Idris Okuneye wey pipo sabi as Bobrisky.

Dem born Bobrisky as man but im dey call imsef ‘Mummy of Lagos’ and e also be crossdresser.

Bobrisky grow im brand for era where snapchat become popular, e use di platform to grow im popularity, monetize am, and cement im brand as a fashionista and social media influencer.

So for Nigeria, over di years, e don become a constant and familiar feature for di social circle. E don get im own share of controversies, make news here and dia but no be until dis year wey Bobrisky enta controversy wey be like e no dey go away anytime soon.

Court for Nigeria sentence am to six months in prison for naira abuse, dat mata alone cause controversy, but na di controversies wey don follow am since e comot from prison and di latest say authorities don arrest am again na im dey make headlines at di moment.

Bobrisky – Crossdresser or Trans?

Bobrisky pose for di camera wit colour wine lipstick and jerry curl hair

Getty Images

Bobrisky bin dey enjoy im fame and popularity for social media platforms.

Di conversation about im sexuality, wetin e identify as and who e really be na something wey sometimes no too dey clear.

Although e bin don address am in one way or di oda for im social media accounts on several occasions, e no dey clear weda e dey serious, catch cruise or talk true.

One big factor wey no go make am come out to speak openly about di mata na because of Nigeria law and culture wey no too encourage am.

Although no law dey for Nigeria wey address cross dressing and transgender, law dey against same sex relationships.

Di Same-Sex Marriage (Prohibition) Bill wey former President Goodluck Jonathan sign into law on January 7, 2014, criminalize public displays of affection between same-sex couples.

Di law impose a 14-year prison sentence on anyone wey “enter into a same-sex marriage contract or civil union. E also impose a 10-year prison sentence on those wey directly or indirectly make a public show of same-sex relationship.”

Although no federal law dey for Nigeria wey specifically address cross-dressing because of di enshrinement of di freedoms humans get for di constitution, regulations wey stop public demonstrations of same-sex affection and oda social and cultural regulations exist for several areas of Nigeria, wey fit get impact on pipo wey dey cross-dress.

So e no dey surprising wen dem dey sentence Bobrisky go prison afta dem find am guilty of naira abuse wen di judge ask am if e be man or woman, e say “I be man”.

Although after e come out from prison, for one interview e grant a content creator, Bobrisky say “I was once a man, but now, I am a very pretty girl”.

Meanwhile for di report of di federal government of Nigeria investigative panel wey chook eye on allegations say Bobrisky get special treatment and e no serve im jail term how e suppose be, dem say e enjoy some privileges for di prison wey include “specially furnished single cells”.

Di panel believe say di peculiar case of di Bobrisky and im physical look and behaviour pose a threat.

Also, dem no get any laid down rule for di treatment of such a case wey involve pesin wit day kain physical look and dat fit don contribute to di privileges wey dem grant Bobrisky for prison.

Timeline of Bob ‘risky’ journey and how e enter di latest controversy

  • 2016 – 2018

Bobrisky, di ‘life of di party’ fit be one of di most popular faces wen you tok about cross-dressing for Nigeria.

E become popular and continue to dey grow during dis period sotay for 2017, im announce say im go begin dey charge N10,000 for viewers wey wan join im Snapchat.

Bobrisky say im go dey show viewers live bathroom sessions, makeup and dancing videos.

From dia, Bobrisky declare imsef as ‘Queen of Snapchat’.

  • September 2019

Bobrisky make headlines for 2019 wen tori break for say police lock di venue wia di popular celebrity wan use celebrate im birthday.

Dis news cause plenti tok-tok on top social media dat year and wen Bobrisky go tok, e appear for snapchat wia e open up say e spend over 19 million naira to plan di party.

To clarify di issue, di den Lagos police tok-tok pesin Bala Elkana tell BBC say na sake of intelligence make dem stop di party.

Wetin be di intelligence? Dem no tok am dat time.

  • 2021

Bobrisky continue to dey use social media especially Tiktok to grow im brand.

Na part of how Bobrsiky find im way into heart of many Nigerians be dis.

Sometimes, Bobrisky go go live for im social media accounts to begin tok different tins – some dey funny, some na warning to ‘haters, while some na how e dey live im daily life as di ‘Mummy of Lagos’.

Popular socialite Bobrisky posing for di camera

Getty Images
Bobrisky na popular celebrity for Nigeria
  • March 2024

Nigeria celebrities react afta Bobrisky win best dressed female award for di Lagos premier of ‘’Ajanaku: Beast of Two Worlds’’ movie.

Bobrisky beat Ogbonge Nollywood stars like Toyin Abraham, Mercy Aigbe, Sola Sobowale wey attend di premier to win di Best Dressed female award and collect one million naira.

Di event take place on Sunday March 25 for Circle Mall for Lekki area of Lagos.

Bobrisky totori di judges wit im black shine-shine gown, big curly hair and black lipstick for di movie premiere.

  • April 2024

For April 2024, di hand of di law touch Bobrisky ova accuse say e abuse di naira wen e dey spray am for different parties.

Sadly, Bobrisky accept say im dey guilty to di offence of naira abuse wen di judge ask am if e dey guilty of di allegations.

Na EFCC bin carry Bobrisky go court initially over di case of money laundering and spraying of naira notes wia dem sama am wit six count charges.

However, Justice Abimbola Awogboro of di Federal High Court for Ikoyi sentence Bobrisky to prison for naira abuse after e plead guilty.

E bin shock many pipo say Bobrisky wey be first-time offender chop prison sentence even wit im influence.

E bin dey sentenced with no option of fine to – six months in prison.

As dem sentence Bobrisky go prison, questions begin dey comot say which kain prison dem go keep am sake of im body features at di time as e bin don claim say e dey transition.

But when di judge wey sentence am to prison bin ask am if e be man or woman, Bobrisky say, “I be man”.

  • August 2024

Bobrisky confam through one video wey show for social media say e don regain freedom from prison.

Bobrisky bin do party to celebrate di release ontop yacth wit some celebrities.

  • September 2024

One social media influencer Martins Otse, alias Very Dark Man (VDM) come out for one video wey don circulate on social media wia e play audio recording wey involve two pipo.

Na for di video, Very Dark Man claim say Bobrisky dey tell pesin for phone say im pay 15 million naira to unnamed EFCC officers to avoid prosecution for alleged money laundering.

E also allege say Bobrisky no serve im jail term for prison.

Di Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, bin direct investigation into di allegations of bribery and corruption within Nigerian Correctional Service (NCoS) wey involve Bobrisky.

  • October 2024

Few weeks afta, di Investigative Panel wey di Minister of Interior Olubunmi Tunji-Ojo bin set up to torchlight di allegations bin come out to say dat dem no see any evidence wey suggest say Bobrisky bin sleep outside di Custodial Centre during di period of im imprisonment.

But, di report say e enjoy some privileges for prison wey include “specially furnished single cells, humidifier, plenty visitation by im family members and friends as e wish, family members and friends dey visit am well-well for inside di office of di pesin in-charge of di custodial center, floor rug, self-feeding.

Dem include say e get inmate wey dey help am run errands, e get access to fridge and television, and possibly access to im phone.”

As dis dey happun, Nigeria Immigration confam say dem arrest Bobrisky wen e dey try to comot di kontri through Seme – a border town between Benin Republic and Nigeria through Lagos.

Authorities confam say dem detain am as pesin of interest wey get questions to ansa.

Source