American rapper August Alsina, start to dey trend on social media afta im tok about im long term relationship with actress Jada Pinkett.
August bin tok on top im relationship for interview wey im do to promote im new album wey e call “The Product 3: stateofEMERGEncy”.
- Dis na why Will Smith latest studio release dey ‘burst pipo brain’
- Will Smith use helicopter bungee jump celebrate im 50 years birthday
E tok about im music and im relationships and na when Jada Pinkett Smith enta di mata, im say, “I bin siddon with Will to tok to am afta im marriage turn to life partnership and im bin give im blessing.
I bin give myself to di relationship for years. And true true, I bin get plenti love for myself for her and I devote myself to her.”
E reveal say e neva fall in love like dat before or since and say “e break me down”.
August tok about di death of im brother and sister and how all those relationships change im way of life.
Di mata bin trend for March 2019 afta oga drop song Nunya wey many pipo bin dey tok say na about im relationship with Jada.
Many pipo for social media don dey chook mouth for di mata, even to di point wey dem accuse Jada of emotional abuse on top di age difference.
Jada out here was creating this mother son relationship with August, knowing how unstable he was, then opened her legs and start sleeping with him to fulfill her sexual predatory sickness. creating the guise of being someone’s loving, nurturing mother figure to only exploit it. pic.twitter.com/iFdZwhQgaj
— SAY NO TO H0E CULTURE! (@FREEKINGRKELLY) July 1, 2020
The sex was so good it made August comfortable with death
That Nigga felt fulfilled, what is Jada doing to these men?
— F A I T H (@Retiredsars) July 1, 2020
This man August Alsina made a whole song about Jada a year ago. Used a gif of her in the vid & put Koren as the contact, which is actually Jada’s middle name🥴… he been admitted about his relations with her, it just went right over yall heads. pic.twitter.com/vctTAv1tXL
— MAJAH🖤🤍 (@IamMajahE) July 1, 2020
Tupac wrote a poem to Jada Smith saying ‘you bring me to climax without sex’ and August says ‘I can die right now and be OK with knowing I had that type of love’ #Jada I just wanna know pic.twitter.com/usJ7glixoV
— itbelikethatsometimes (@GogoDesiree) July 1, 2020
Who be dis August Alsina wey don start di tok on open marriage?
August Alsina na 27 year old R&B singer wey drop im first Album for 2014 wey im call Testimony.
One of im most popular song na Benediction wey im sing with Rick Ross for 2014. For dat year, e also follow Usher for tour.
E don also work with artistes like Nicki Minaj, Lil Wayne, Juicy J, Travis and Trinadad James.
Will Smith and Jada Pinkett don get accuse say dem dey do open marriage since 2013 and e be like for one interview, di Girls Trip actress confam am when she say “I no come dis world to be anybody watcher, e be grown man and I trust am to do wetin dey right.”
However, she comot to reveal say she dey grown relationship with Will Smith not open one.
But now for di Red Table show wey Jada Pinkett Smith bin dey host, she don admit say true-true she bin get affair with singer August Alsina while her marriage to American actor Will Smith bin dey shake.
Jada tok as both she and her husband Will Smith sit down for her Facebook show to address tok-tok about her relationship with Alsina.
Jada explain say di couple become friends with August, 27, four years ago through dia son Jaden, 22.