Meet di contestants for Miss universe Nigeria 2024

25 beauty queens from across various states go compete for di Miss Universe Nigeria pageant dis August.

Chidimma Adetshina, wey quit di Miss South Africa beauty pageant last week sake of nationality wahala, dey among di pipo wey dey compete for dis pageant.

She join di pageant afta she accept invitation from di organizers.

Di model father na Nigerian while her mama get Mozambican roots but dem born her for South Africa.

Posting on Instagram on August 8, she say I make di “difficult decision” to quit di contest to protect di “safety and wellbeing of my family and me.”

One day afta Adetshina announce her withdrawal from di Miss South Africa pageant, na im di organizers of Miss Universe Nigeria invite her to compete.

Dem say, “na opportunity to represent her father native land for international stage” and dem add say her “journey for di world of pageantry neva end.”

Miss Universe Nigeria say di koko of di pagent na to provide platform for Nigerian women to showcase dia beauty, intelligence and cultural pride to di world.

Ugochi I hezue di reigning Miss Universe 2023 go crown her successor for di grand finale for August 31.

If Adetshina win Miss Universe Nigeria, she go represent di nation and she go jam Miss Le Roux for Miss Universe competition wey go take place for Mexico for November.

DI event go feature more than 80 women from around di world wey dey aspire to become Miss Universe.

Dem go select dem from selected events wey include personal statements, in-depth interviews, evening gown, and swimsuit competitions.

Sheynnis Palacios from Nicaragua na di reigning Miss Universe

For Nigeria, di countdown to di grand finale don start, all eyes go dey on Eko Convention Centre on August 31, na dia dem go crown di next Miss Universe Nigeria.

Voting, na important element of di competition. Dis go allow audience to cast dia vote for dia favorite contestant as many times as dem want until August 30 wen e go end.

Meet di contestants:

  1. Abia– Chioma Nkumeh
  2. Abuja – Lucille Oputa
  3. Akwa Ibom – Happiness Enetak
  4. Anambra – Paula Ezendu
  5. Bayelsa – Fortune Kurobo
  6. Benue – Joy Omanibe
  7. Cross River – Emmanuella IGBODOR
  8. Delta – Sarah Olotu
  9. Ebonyi – Mother Theresa Orji
  10. Edo – Edeifo Aikhuele
  11. Ekiti – Esther Gabriel
  12. Enugu – Uchechi Uchenna
  13. Imo – Queeneth Igbokwe
  14. Kaduna – Sophia Nelson
  15. Kogi – Zuleihat Oyarazi
  16. Kwara – Ufa Dania
  17. Lagos – Favour John
  18. Niger – Priscillia Umehea
  19. Ogun – Deborah Anosike
  20. Ondo – Peace Ayegbidun
  21. Osun – Ifunanya Nledo
  22. Oyo – Elizebeth Salawu
  23. Plateau – Chioma Ogbona
  24. Rivers – Nyekachi Douglas
  25. Taraba – Chidimma Adetshina

Source