Wetin you need to know about mpox vaccine

Man dey collect Mpox vaccine for one health centre for Los Angelos, US.

Getty Images

Di European Centre for Disease Prevention and Control don advise travellers make dem consider to take mpox vaccine if dem dey plan to visit kontris for Africa wia di disease dey worry.

World Health Organization say East Africa kontris like DR Congo, wia di disease bin first come from, and odas like Burundi, Kenya, Uganda and Rwanda wey bin never get di disease before, all of dem don recently report new cases, although di numbers dey go down.

Di European centre for disease control update im recommendation sake of dis latest WHO announcement say dem don discover new strain of di virus.

WHO say di risk of di virus spreading dey low, even as dem just declare mpox wey dem bin sabi before as monkeypox as global emergency.

Mpox na disease wey pesin fit catch wen e get contact wit who get di disease, including through sex.

Mpox vaccine

WHO Advisory Group of Experts on Immunisation (SAGE) don recommend two dose of Mpox vaccines wey WHO-listed regulatory authorities also don approve.

Di virus wey dey cause mpox, na di same virus dey also cause small pox. Diafore, di JYNNEOS two dose vaccine, wey dem develop, dey protect against both mpox and small pox.

According to di US Centre for Disease Control and Prevention, pipo need to take di two dose of JYNNEOS, wey pharmaceutical company Bavarian Nordic dey manufacture.

To get di best di best protection, dem must to take di second dose four weeks afta dem take di first one.

So far, di Nigeria goment never officially announce any special healthcare facilities wia pesin fit go collect di mpox vaccine, but pipo fit discuss wit dia doctors for advise on wia to go.

Possible side effects

Like every oda vaccines, di mpox vaccine fit make some pipo get some side effects wen dem collect di vaccine.

Some of di common side effects wey pesin fit get from collecting di JYNNEOS vaccine na:

  • Di place wey you collect di injection fit pain you, turn red, swell, become hard or itch
  • muscle aches
  • fatigue
  • nausea
  • fever
  • headache
  • chills

You fit manage any one of dis side effects if e happun to you.

But, if you collect di vaccine, come dey feel like say you get allergic reactions like say you no fit breath, you wan collapse, or you dey breath up up, make you dey waka go hospital kia kia.

Oda symptoms wey be say if you notice any of dem you need to go hospital sharpaly na, chest pain, irregular breathing, pressure or discomfort or you dey notice new or unexpected side effects.

Source