Wetin be di fate of Ghanaians wey trap inside Israel-Palestine war

Bomb shelters dey for many places for cities in Israel.

Getty Images
Destroyed scenes for Isreal

Even though di attack for di Palestine-Israeli conflict dey happun for di south, many cities and towns dey feel di impact.

Wilson Ofosu be Ghanaian wey dey live for Rishon LeZion for di central part of di kontri.

But occasionally, im dey hear sirens dey blast wia dey signal say rocket dey come im location.

Pipo dey manage in fear

Wetin dey happun be say “if di siren blast, you for find bomb shelter den hide. Di siren go sound for like one minute,” Wilson tok BBC news pidgin.

Bomb shelters dey for many places for cities in Israel.

Dis na safe places wey dem take reinforced concrete build as shelter for pipo if say bomb dey blast.

Di kontri get one technology dem call iron dome system wia dey neutralize rockets for di sky.

Na so many of di rockets from gaza wia dem fly to di kontri dey blast for sky.

Wilson dey hear dis loud blast from where e dey.

“E bi scary, I never witness anytin like dis before.”

For areas wey dey di south, di impact DEY devastating.

Even though di iron dome technology dey release rockets to neutralize those from gaza in di sky, debris dey fall for ground.

Nicholas Nantwi (no be im real name) don witness one blast like dat for Ashkelon.

“Few minutes afta di blast, we commot one bomb shelter wia we see metal blocks and oda debris from di rocket dey fall for ground.”

Nicholas say “e no be safe to come out of di bomb shelter immediately di blast sound go down.”

Na so e take fear leave Ashkelon go anoda city.

How di war dey affect dia lives

For Wilson, wetin go happun next for Rishon LeZion be something e dey think about.

For now “streets for here be empty, sometimes I be di only pesin wia dey di bustop dey find bus go house.”

“E bi really scary cos you never know wen di hamas militants go invade dis city,” Wilson tok.

Businesses don dey slow down for di area, some residents no dey go work.

Pipo dey struggle to get water to buy, di few packs wey dey malls don finish.

Some dey restrict dia movements wia for di food industry, online orders dey rise.

For areas like Kibbutz, Sderot and Ashkelon pipo continue dey live in fear.

At least 1,200 don die for di war wit many odas injured.

Gaza militants also don take 150 hostages during di attack.

Israel dey lay siege for Gaza until dem go release di hostages.

Di kontri’s energy minister Israel Katz say “we no go turn on any electrical switch, we no go open any water hydrant wia no fuel truck go enter di kontri.”

Wetin Ghana foreign ministry tok

Di ministry no release di exact number of Ghanaians wey dey live for Israel, but dem go fit be at least one thousand, according to Wilson Ofosu.

Im tok say e no hear any message from embassy officials about wetin dem for do.

But among themselves, dem get one whatsapp platform wia dem dey share information as Ghanaians wey dey live for Isreal.

For one statement di foreign affairs ministry release, dem tok say dem dey on top di situation for Isreal.

Di ministry tok say Ghanaians for Isreal for use some hotlines take contact dem “in case of emergencies as di fighting dey go on.”

Di hotlines be

00972 54 8662 281

00972 54 9316 007

00972 54 6741 553

“We dey assure di public say all our compatriots for Israel be safe. We go give updates as di situation don dey develop,” di ministry add.

Dem also use di press statement clarify say one viral video wey dey show some Ghanaians dey stranded for some location, no be video from Isreal.

Dem add say di video no be related to di ongoing Palestine-Israeli conflict.

For now, Wilson, Nicholas and di oda Ghanaian citizens wia dey Israel go hope say di conflict no go escalate.

Evacuation?

Sources for di foreign affairs ministry say dem do reach di stage wey dem go remove Ghanaian citizens from Israel.

However dem say dem dey constant touch wit dia officials for di kontri to ensure di safety of citizens.

Deputy head of mission at di embassy of Israel, Aviel Avraham tok say “Israel dey ready to guard di safety of everyone including Ghanaians.”

Im add say dem dey work to ensure di situation go return to normal, as “authorities don dey share information among themselves on di way forward.”

Source