Coronavirus cases in Lagos: Sanwo-Olu don pass order say ‘Lagosians must use face mask from now on or face di law’

Lagos state goment don give order make evribodi wey dey enta public space for di state wia face mask or face di law.

Govnor Babajide Sanwo-Olu wey give di order on Saturday add say goment don make arrangement for mass production of face mask.

Di Lagos State goment bin pass one new law wey give di govnor power to pass order and make declaration wey go helep di fight against di new Coronavirus.

https://www.facebook.com/bbcnewspidgin/videos/168305431100271/

Di govnor beg private organizations to patronize local face mask producers and share to dia workers.

E say face mask don become business wey small and big business suppose take advantage of.

Lagos don get over 600 confam cases of Covid19 and local transmission dey on di increase according to di govnor.

Na at least 20 million pipo dey live inside Lagos wey be di bizness capital of Nigeria.

Since 30 March, 2020, na only Lagos and Ogun States for south west region and Abuja, di political capital of Nigeria be di places wey Presido Muhammadu Buhari order lockdown for, sake of di Coronavirus outbreak.