Seychelles declare state of emergency afta huge explosion

General view of Seychelles capital Victoria

BBC
Di explosion happun for one industrial area just south of di capital, Victoria

Seychelles President Wavel Ramkalawan don declare state of emergency for di kontri, afta one very heavy explosion plus flooding happun for one industrial zone on di main island, Mahé.

Di Seychelles leader don order all citizens except essential workers to siddon for house.

Plenty pipo injure sake of di explosion.

Di blast happun for one construction and quarrying company, wia dem dey store explosives, di explosion cause serious havoc for di industrial zone of Providence.

Di international airport also dey affected, even though e dey 4km (2.5 miles) away.

Schools dey closed and di only movement wey dey allowed na into and out of di holiday islands.

“Di Seychelles international Airport still dey operational and ferry services between islands dey work for visitors,” di kontri official account post on X.

UK government don advice dia citizens for di island of Mahé to remain indoors until further notice.

One unusual heavy rain wey fall overnight bin cause serious flooding and landslides.

Three pipo die wen dia houses destroy.

Di flood don cause dirty to flow inside ocean and authorities don advise pipo say make dem no swim.

President Wavel Ramkalawan as e dey tok on national TV call di twin disaster “calamity” for di kontri, and beg pipo to show solidarity to those wey di mata affect.

Seychelles kontri profile

Map of Seychelles

BBC

Di Seychelles dey made up of 115 islands and e be di least populous kontri for Africa wit about 100,000 pipo.

Di Indian Ocean archipelago dey enjoy high per capita income, good health care and education.

Di former British colony economy depend heavily on di fishing industry and big market tourism.

Seychelles also na home to different wildlife, including giant tortoises and sea turtles. Much of di land dey protected as part of nature reserves.

REPUBLIC OF SEYCHELLES: FACTS

  • Capital: Victoria
  • Area: 459 sq km
  • Population: 100,447
  • Languages: English, French, Seychellois
  • Life expectancy: 72 years (men) 82 years (women)

Source