Malawi VP Saulos Chilima, odas die for plane crash

Malawi Vice President and all di passengers wey dey on board for di military aircraft wey go missing don die.

Malawi president Lazarus Chakwera confam di death during im briefing on Tuesday.

E say dem find di remains of di aircraft near one hill and e dey “completely destroyed” wit no survivors.

Earlier, one senior military official say di plane wey dey carry Malawi vice-president fit don crash inside forest for di north of di kontri.

Saulos Chilima and nine odas bin dey fly within di kontri on Monday morning wen dia aircraft disappear from airport radars.

Di military tok say di airplane dey fly for bad weather.

Soldiers don dey search Chikangawa Forest as dem dey make effort to find di plane.

For a press briefing on Tuesday, Malawi Defence Force commander Paul Valentino Phiri say di weather condition bin reduce how dem fit see di airplane for di forest and e no allow dem do proper search.

President Lazarus Chakwera say di rescue mission must gatz continue until dem find di plane.

“We dey unable to land di plane due to bad weather and poor visibility. Aviation advise say make di pilot return to di runway, na so we lost contact wit di pilot. I don order say make operations continue until dem find di plane.

“I know say we dey concerned and dey fear – I dey concerned too,” e tok.

Wetin happun bifor

Malawi Vice President Saulos Chilima

AFP

One military aircraft wey carry Malawi vice president Saulos Chilima bin miss wey make authorities begin search for am, di kontri Information and Civic Education Minister Moses Kunkuyu tok.

Di Malawi Defense Force say di aircraft “go off di radar” afta e leave di kontri capital, Lilongwe, on Monday.

Na Malawi Defence Forces get di plane and di commander of di Defence Force brief di kontri president afta di incident, di minister tok.

E add say e dey too early to tok di reason for di disappearance of di aircraft.

Oda passengers on di flight na some officials from di vice-president United Transformation Movement (UTM) party.

Di president order search and rescue operation afta aviation officials say dem no fit contact di aircraft.

Di vice president suppose land for Mzuzu International Airport around 11 on Monday but dem neva see di plane till now

Malawi President Lazarus Chakwera cancel im scheduled flight to di Bahamas afta e hear di tori.

Di Vice President bin dey travel to represent di goment for di burial of one former cabinet minister, Ralph Kasambara wey on 7 June.

Profile of Malawi Vice-President Saulos Chilima

Malawi Vice-President Saulos Chilima bin serve as VP for for 10 years. Im first start under former President Peter Mutharika, wey bin pick am from di business sector for di second most senior post in goment.

Na on 12 February 1973 dem born Chilima for Ntcheu district for central Malawi.

Dem describe am a “performer” and “workaholic” but some even say im dey di centre of corruption allegations for goment.

Bifor Dr Chilima become vice-president for 2014, im na di managing director of di leading telecommunications firm Airtel Malawi, di first Malawian to head di organisation.

But four years later, Dr Chilima bin fall out wit di den president Mutharika, accusing di goment say dem no dey do enough to fight corruption and dem dey protect some pipo.

Under Malawian law di president no fit fire di vice-president and late Chilima no ansa pipo wey dey call for im resignation.

Im later form im own political party called di United Transformation Movement (UTM) wia im dey call for radical change and reform for di kontri.

Im contest for president for 2019 as di party candidate wia im carry third.

Mr Mutharika win di election but a top court for Malawi bin cancel di elections sake of complain say e get plenti mago-mago.

Na di first time for Africa wey election result go dey overturned by a court and den dem defeat di sitting president in a re-run.

Dr Chilima join president Lazarus Chakwera as running mate for di historic 2020 re-run.

President Chakwera wey come second for di 2019 election wey dem cancel bin dey later elected as president, and Dr Chilima become im vice-president.

Bifor im role as political heavyweight for Malawi, Dr Chilima bin hold oda senior roles for corporate sector wey include Coca Cola and Unilever.

Im na economist and im get PhD in knowledge management.

As im dey serve as VP for goment, na im also be di minister wey dey responsible for economic planning and public sector reforms.

Im leave behind wife Mary and two children, Sean and Elizabeth.

We dey update dis tori

Source