Grammy winners 2021: Wizkid go collect statuette for im Best Music Video category win with Beyonce, Blue Ivy, for di 63rd annual ceremony? – See wetin di Grammys tok

Collage of Grammy Awards and Wizkid

Getty Images

Nigerian artiste Ayo Balogun, AKA Wizkid win im first Grammy awards for di Best Music Video category inside di 2021 award ceremony.

Beyonce song, Brown Skin Girl wia she feature di popular Nigerian artiste, Wizkid na im gbab di 2021 Grammy awards for Best Music Video.

Nigerians on social media dey divided as to weda Wizkid wey be featured artist on Beyonce music video, go get di Grammy Awards gramophone trophy alongside Beyonce.

But wetin di rule tok?

We torchlight a to find out.

See Grammy rules on featured artiste

To be recognized as a GRAMMY nominee, featured artiste must dey credited as a featured artist wen dem submit di song and e must make a significant and artistic contribution to di song.

Featured artists also dey GRAMMY- eligible for Album of The Year if dem perform on more than 33% of di playing time of an album.

Featured artist also dey eligible for di genre album categories if dem perform on more than 51% of playing time.

For performance category, featured artiste dey eligible if di owner of di song credit dem on di track/single.

If dem credit an album to one artiste and e get plenty artistes wey sing for many of di tracks , dem fit consider di album as “Various Artists” album.

Dis go depend on case-by-case basis by di Academy.

Grammy Statuettes

Getty Images

Who dey collect statuette for Best Music Video?

For di Best Video category wey Wizkid win with Beyonce, her daughter Blue Ivy, di list of pipo wey go collect di Gramophone trophy wey di Grammy Academy dey give na: Di Artistes, Video Director & Video Producer.

Dis one mean say all di artistes wey feature for di music video (wey dem credit) plus di pesin wey direct di video and di video producer go get their own individual statuette, according to di rules of di Academy.

Audio Producer, Audio Mixer and Video Editor of di winning music video go collect Grammy certificate.

Wetin dis rule mean for Wizkid?

Wizkid dey eligible to receive di Grammy Statuette as im be artiste wey feature for Beyonce song, ‘Brown Skin Girl’ (Winner of di 2021 Grammy awards).

How Nigerians react as Wizkid win first Grammy award

How Wizkid rise to be Grammy winner {Wizkid biography}

Wizkid real name na Ayodeji Ibrahim Balogun sometimes pipo dey also call am Starboy, Wizzy.

Di Nigerian born singer and songwriter na one of Africa’s biggest artistes.

Wizkid na one of di most decorated Nigerian artiste and even one of di most African artiste wey don get international recognition.

Di Afro pop artist start im music career at di age of 11 and im manage to release one collaborative album wit di Glorious Five, one group wey he and a couple of im church friends bin form.

Wizkid sign one record deal wit Empire Mates Entertainment (E.M.E) for 2009.

He become popular after im release “Holla at Your Boy”, di lead single from im first studio album Superstar for 2011.

“Tease Me/Bad Guys”, “Don’t Dull”, “Love My Baby”, “Pakurumo” and “Oluwa Lo Ni” also dey di album.

Wizkid comot from E.M.E after im contract expire.

For 2016, Wizkid achieve international recognition after im collabo wit Drake on di global hit, “One Dance”, wey reach number one in 15 kontris.

He sign one a multi-album deal wit RCA Records for March 2017.

Wizkid become di first Afrobeats artist to appear for di 2018 Guinness World Records for im contribution to “One Dance”.

In 2019, he feature for Beyoncé project The Lion King: Di Gift on di collaboration “Brown Skin Girl”, wey make am win im first Grammy Award for Best Music Video.