Who be Nikocado Avocado di popular YouTuber wey don shake internet wit im weight loss?

YouTube logo

Getty Images

YouTube content creator, Nikocado Avocado don scata internet wit one new video wey im bring out showing say im lose 250 pounds in secret.

On Saturday, di mukbang star come di platform for two part videos to reveal wetin im call, “di greatest social experiment of my entire life”.

E show for di first video wit panda head on, wey im remove am to reveal im thinner self say, “I be di villian becos na wetin I make myself. You go kontinu to dey consume dis tori about me, year afta year, for as long as I tell internet say I be di villian”.

Nikocado Avocado wey im real name na Nicholas Perry, bin join YouTube as violin player and vegetarian, bifor e start to dey do meat inclusive mukbang videos.

Wen e stop to be vegetarian, e tok say na becos di community bin dey toxic.

According to im video wey im reveal im new weight, Nikocado reveal say im don make plenti content put for ground bifor im start im weight loss journey.

According to am, e say “I neva make any new video in the last two years.”

Dis na as e bin post content wey im dey fat as recently as last week for di video sharing platform.

Nikocado Avocado, bin blow up in popularity around di late 2010s on top im weight gain and how e bin dey pick fights wit oda content creators for di platform.

Notably, wen e start to dey add weight and pipo start to tok on di mata, e bin tok say e bin healthy pass as e add weight than eva bifor.

But for video wey im release for April, e tok say, “I hate my life. I bin get sometin wey fit give me respect and now I dey make content for pipo wey no like me.”

For di recent videos, e call di last eight years wey e bin dey get im weight issues say, “na bad dream e all be”

Who be Nikocado Avocado

Dem born am as Nicholas Perry for May 19, 1992 for Ukraine bifor im parents adopt am and carry am come America.

Bifor e start to dey regularly post for YouTube, e bin dey work on im dream to play violine for Broadwa show.

For 2013, e move go New York City becos of dis dream. Infact for im first time wey im bin dey play violin or di theatre, Nicholas reveal say e be solo violinist for di project. Tori be say e also perform for Season 2 of di Glee Project.

Na for dat same period im meet im partner Orlin Hope, wey bin join am for content for almost all of im online career and tori be say na becos of im Nick chook hand for content creation.

Nikocado Avocado bin start im career for YouTube for 2014, wia e bin dey post videos of im life as vegan as well as share content from wia e dey play violin.

E bin also dey do mukbang wey be videos of pipo wey dey chop plenty food, but e bin dey chop vegan food dat time and dey tok about living di vegan lifestyle.

Dat na until, September 2016, wey im leave di vegan community say e bin dey toxic and later on stop to dey chop di vegan diet sake of health reasons.

For March, 2017, na wen Nick start ot dey tok about im weight and start to dey get more and more controversial.

Source