Cyril Ramaphosa sworn-in as South Africa president for second term

Cyril Ramaphosa

Getty Images

Cyril Ramaphosa don take oath of office to become di president of South Africa for di second term at di Union Buildings.

Di theme of di inauguration na “30 Years of Democracy, Partnership and Growth.”

Chief Justice Raymond Zondo administer di oath of office on Wednesday during di inauguration.

“Ladies and gentlemen, di President of South Africa”, di chief justice tok a im raise di hand of Ramaphosa.

South Africa parliament re-elect Cyril Ramaphosa as di kontri president afta a landmark coalition deal between di governing African National Congress (ANC) and opposition parties.

Di new goment of national unity combine Ramaphosa ANC, di centre-right Democratic Alliance (DA) and smaller parties.

During im victory speech, Ramaphosa hail di new coalition, and tok say voters expect di leaders “to act and to work togeda for di good of evri one for our kontri”.

Dem make di agreement on a day of high political drama, wey see di National Assembly sitting late into di evening for votes to confirm who go hold power for di new administration.

Some presidents and head of states representatives enta South Africa to witness di inauguration.

Nigeria President Bola Tinubu, King Mswati III of di Kingdom of Eswatini, Cuba Vice President Salvador Valdés Mesa, Zimbabwea President Emmerson Mnangagwa for for di leaders.

Odas wey attend na Samia Hassan of di United Republic of Tanzania, Côte d’Ivoire Vice President Tiemoko Meyliet Koné and Ghanaian President Nana Akufo, amongst odas.

Who go dey Ramaphosa cabinet

President Ramaphosa go announce who go dey im cabinet for di 7th administration for South Africa. E neva clear wen Ramaphosa go announce im cabinet.

Di DA, IFP, Patriotic Alliance (PA) and some oda smaller parties wey support di nomination of Ramaphosa as president go dey expect make di president reward dia parties wit appointments.

Meanwhile, for 2019 wen Ramaphosa bin first win di election, na about four days e take am to announce im cabinet members.

Wetin Ramaphosa tok for im inaugural speech

“We gather to affirm our solemn conviction dat dis kontri belong to dos wey dey live for am. “We shall overcome di ongoing inequalities, we go build equal nation.

As we enta anoda era for our kontri, di resilience of our democracy. Di pipo of South Africa don vote to make known dia aspirations, we say yes, di South Africans don speak and we accept.

Di pipo no give any single party opportunity to govern South Africa alone, dem want make we work togeda.

Dem want a transformed and improved economy. Dey want a South Africa wia dey find shelter and loving families.”

“Through dia votes, dey say dey want water wey dey clean, decent homes dat keep out cold, well maintained roads and streetlights wey dey work, dey for proper healthcare and education.

I go work wit everi political parties and sectors wey dey ready to develop South Africa. I go be president for all South Africans- to work wit dos wey dey in need.”

Source