Euro 2024 group table afta matchday one

Euro 2024 Group standings

BBC

All eyes bin dey 39-year-old Cristiano Ronaldo ahead of Portugal European Championship opener against di Czech Republic – no be for di first time for Germany, na one youngster wey tiff di headlines.

‘Ronaldo 7’ shirts bin dey evri wia for Leipzig bifor di game, as fans prepare to welcome di old time forward record appearance for im sixth European Championship.

Di fans bin get plenty hope say e go mark im return wit a goal but dat one no happun and instead na Francisco Conceicao – wey dey 18 years younger dan Ronaldo snatch di dramatic winner as Portugal start dia Group F campaign wit a 2-1 victory.

Na just im first touch afta e enta for im competitive debut, and former England striker Alan Shearer happy wit im contribution.

“Dem send you in to change di game and to do something,” e tok on BBC One. “You gatz make impact as a sub.”

Na memorable moment for Conceicao, son of former Portugal player Sergio, and na one wey e celebrate wit a delighted Ronaldo, wey punch di air and high-fived im team-mates.

Portugal boss Roberto Martinez say di youngster deserved im winning moment.

Despite di win, Portugal dey second place for Group F behind Turkey – dia next opponent on Saturday.

Euro 2024 bin start on Friday, June 14 wit hosts Germany defeating Scotland 5-1 for di opening game for Allianz Arena for Munich.

Dis tournament go see a total of 51 games across 10 venues.

Each team go play di oda three sides for dia group once for a single round-robin format.

Di top two teams from each group and di best four third-placed teams go qualify for di round of 16.

Group A

Euro 2024 table

BBC Sport

Group B

Euro 2024 group table

BBC Sport

Group C

Euro 2024 table

BBC Sport

Group D

Euro 2024 table

BBC Sport

Group E

Euro 2024 table

BBC Sport

Group F

Euro 2024 table

BBC Sport

3rd Place ranking

Euro 2024 qualification groups

BBC Sport

Wednesday Euro 2024 fixtures

19 June

  • Group A: Germany vs Germany (Stuttgart Arena 17:00 WAT)
  • Group A: Scotland vs Switzerland (Cologne Stadium 20:00 WAT)

Na two to four games dem go play evri day until 26 June bifor dem go start di round of 16 stage for 29 June.

Na Sunday 14 July di tournament go end for di Olympiastadion for Berlin.

Source