World Internet Day 2021: October 29 na World Internet Day, see di history and significance

World Internet Day 2021: October 29 na World Internet Day, see di history and significance

Getty Images

World Internet Day na special day to remember di first message wey dem send between two computers on October 29, 1969.

Di first message through ARPANET internet processor na to programmer Bill Duvall for Stanford Research Institute.

Dat time na UCLA professor Leonard Kleinrock and im student and programmer Charley Cline bin dey share di message.

Since dem send dis first message for 1969, internet technology don become one of most important part of our lives.

And internet go be di most crucial part of our future.

Internet don transform di way we take dey live our life sotey, e hard to tink how we wan take live for dis world witout am.

World Internet Day 2021: October 29 na World Internet Day, see di history and significance

Getty Images

History and significance of World Internet Day

Di first time dem celebrate International Internet Day na on October 29, 2005.

Dat day for 2005 bin be unofficial holiday wey commemorate di celebration di date wey dem send di first electronic message “LO” from University of California, Las Angelos (UCLA) go Stanford University.

Charley Cline bin try to send di word “login” but somehow im only manage to send di letter “LO” before di connection between di terminals crash.

Dis na just few months afta Neil Amstrong take im first step for moon. At time dem sabi internet as Advanced Research Projects Agency Network (ARPANET).

Twenty years afta for 1989, dem invent di World Wide Web.

Since dat day reach today, di internet dey grow, dey revolve, dey expand dey go.