‘Na Tuwo I first chop after tears of joy for seeing my family’ – Sudan returnee

Fatima say to return no dey her mind for now

BBC
Fatima say she first chop Tuwo wey be Hausa delicacy as she reach house

Fatima Sanusi Musa wey be student of International University of Africa for Sudan describe di feeling to BBC News Pidgin after she re-unite with her family for Nigeria on Monday.

Di 400 level Dentistry student dey among di last batch of Nigerians wey arrive di kontri from Egypt wey dem run go due to di kata kata wey dey happun for Sudan.

“No be small tears of joy comot from my eyes after I see my family because I think say I go die for Sudan because of wetin dey happun.”

She tok say after dem return home from airport she ask for her favourite food wey she bin dey miss wella.

“Na tuwo I first ask for as I don miss am wella.”

Di student family pick her up from Mallam Aminu International airport for Kano northwest Nigeria alongside oda families wey go pick dia children.

Fatima tok say she no dey think of return at di moment despite say na just one year remain for her studies.

“For now to return no dey my mind until everything don end.”

“For Khartoum our hostel dey very close to di military headquarters wey make us easy target.”

“E get time wey some soldiers even come and ask all of us to lie down flat at dat point all of us think say we go die.”

‘If di war no stop I go seek my daughter transcripts’

Fatima and dad

BBC
Fatima and her father

Fatima father Sanusi Musa wey also express happiness on seeing im daughter return to Kano and dia home tok say dem go first wait to see how tins pan out.

“So for now we go wait see how tins go be if di war end and dem call dem back she go return to finish her studies since na one year remain for her.”

“But if di war carry on for long we go seek transcripts from di school so dat she go fit complete her education for here.”

Di father say to sleep bin hard im and Fatima mother after di war break out.

“After we speak to her on phone she describe wetin dem dey go through e come am worse for us because at all times we dey think of her.”

“I happy wella when she return home no be small.”

Director of Special Duties for National Emergency Management Agency, Dr Onimode Abdullahi Bandele, tok say over 1000 Nigerians still dey stuck for Sudan and plans dey underway to comot them as soon as possible.

Na 129 Nigerians return on Monday from Port Sudan for di last batch wey flee di war.

Toks to end di war still dey go on for Saudi Arabia

Fatima doing some chores for house

BBC
Fatima dey helep her family cut vegetable for soup

Representatives from Sudan armies wey dey fight dey inside Saudi Arabia for dia first face-to-face negotiations.

Di “pre-negotiation toks” between di Sudanese army and di paramilitary Rapid Support Forces (RSF) start on Saturday for Jeddah. Na US and Saudi Arabia sponsor dem.

Although tori pipo neva report any progress since di tok tok begin for di Arabian kontri.

Dem don break many ceasefires since di fighting begin weeks ago.

Both sides bin don tok say dem go discuss humanitarian truce but no be end to di conflict.

Wetin dey cause di katakata for Sudan

Fatima doing some chores for house

BBC

Di Sudan army and di paramilitary Rapid Support Forces (RSF) fight for weeks now don kill ova 400 pipo.

Since di 2021 coup for Sudan, na council of generals wey two military men dey lead dey run Sudan.

Dis two military men na dem dey di centre of di crisis inside di kontri.

Gen Abdel Fattah al-Burhan, wey be di head of di armed forces and in effect di kontri president.

And im deputy and leader of di Rapid Support Forces (RSF) Gen Mohamed Hamdan Dagalo, wey dey known as Hemedti.

Two of dem disagree with each oda on di direction wey di kontri dey go and di planned move to bring civilian rule.

Di main issue na plans to include di 100,000-strong RSF into di army, and who go den lead di new force.

Gen Dagalo don bin tok say di 2021 coup na mistake and don try to present imsef and di RSF to show say dem dey di pipo side, against di Khartoum elites.

While e get some support, odas find dis message hard to believe sake of di paramilitary force wicked track record.

Meanwhile, Gen Burhan don bin tok say di army go only fully hand ova power to elected goment.

But suspicion dey ground say both military men, and dia supporters, dey worried about wetin fit happun to dia wealth and influence if dey remove dem from dia powerful positions.

So far, no Nigerian don die for di katakata as goment don tell parents to calm down say dem go do dia best to evacuate di students safely.