Ogbonge Nigeria actor Abdulsalam Ishola wey pipo sabi as Charles Olumo Agbako, don die at di age of 101.
Di President of di Theatre Arts and Motion Pictures Practitioners Association of Nigeria (TAMPAN), Bolaji Amusan popularly known as Mr Latin announce di death for one post on im Instagram page.
- How Nollywood mourn popular ogbonge comic actor Mr Ibu wey die afta sickness
- ‘I go fight with my last blood to get justice for my daughter’ – Priscilla Ocheme mama
- Mohbad death – US lab give update on autopsy check, result
Charles Olumo na ogbonge actor wey dey popular for di Yoruba Nollywood movie industry for Nigeria.
According to tori wey reach us, Charles Olumo bin die on Thursday morning 31 October 2024 afta e say im wan go rest.
One of di pikin of di deceased, Motunrayo Iwa wey also confam, say her papa don die, say di burial arrangement go begin dis evening.
For 2022, late Charles Olumo bin follow BBC tok on di kain sickness wey dey trouble am.
Who be Charles Olumo
Im papa and mama name am Abdulsalam Ishola but for di movie industry sabi am as ‘Charles Olumo Agbako’.
For one interview wit di BBC, Charles Olumo say e get di name ‘Agbako’ sake of how e dey important to get nickname for di acting industry. E say na why im give imsef dat name.
‘Agbako’ na name wey mean ‘fear’, e say na why im choose dat name.
Dem born Charles Olumo for 1923 and e die for 2024 at di age of 101 years.
Im join di movie industry for ova 60 years and e make impact and collect awards.
E dey known for im way of using di Yoruba language to make incantations and proverbs.
We dey update dis tori