Warning: Dis tori contain details wey fit turn your belle.
Several women don take dia lives for Sudan central Gezira state afta paramilitary fighters for brutal civil war wey dey shele for di kontri rape dem, rights groups and activists tok.
Di reports dey come afta di paramilitary Rapid Support Forces (RSF) chop accuse by di UN of “atrocious crimes”, wey include mass killings, for di state last week.
As RSF fighters dey continue to advance, one rights group tell di BBC say dem dey in contact wit six women wey dey tink of taking dia own lives as dem dey fear say dem fit be victims of sexual assault.
But di RSF don dismiss one recent UN report wey blame blame a rise in sexual violence on dia combatants – dem tell BBC say di accusations “no be evidence based”.
Di vicious struggle for power between di army and RSF don kill tens of thousands of pipo and force more dan 11 million pipo from dia homes since di conflict begin for April 2023.
- ‘Rape me instead of my daughters’ – women tok about Sudan horrific war
- ‘Ova 12 million pipo dey starve’ for war-hit Sudan – WHO
Di head of di UN World Food Programme, Cindy McCain, bin visit di aid hub of Port Sudan dis week, and tell di BBC say di kontri fit see di world largest-eva humanitarian crisis if a ceasefire no happun.
She warn say millions of pipo fit die from starvation.
Reports of paramilitary fighters on di rampage for Gezira dey follow recent defection to di army of Abu Aqla Kayka, di RSF top commander for di state.
We dey update dis tori