10 pipo die, seven injure inside building collapse for Ibadan

Building collapse for Ibadan wit iron sheet and stones. Na 2019 e happun

BBC
Foto of collapse building for Ibadan wit iron sheet and stones wey happun for 2019

Di authorities for Oyo state don confam say one building collapse for part of di state don claim lives of 10 pipo alreadi while eight odas dey fight for dia lives.

Di building collapse bin happun on Thursday 31 October, 2024 for Jegede area of Ibadan, di state capital.

For midnight wen pipo dey sleep around 2am, a storey building wia pipo dey live bin suddenly collapse.

Police neva clear wetin cause di building collapse but dem say dem dey begin investigation into di incident to know wetin lead to am.

According to di statement of di police, na 10 pipo die immediately wen di building bin collapse leaving about eight pipo wit plenti injuries.

“Adequate securiti don currentl dey for di area to prevent make hoodlums no take-ova di scene wia di incident bi happun and also to protect di lives and property of oda residents within di area,” di police tok

Meanwhile, according to di Oyo state fire service, rescue operation still dey go on afta dem rescue some pipo from di collapse.

Di General Manager of di Fire Service, Yemi Akinyinka say dem receive call wey trouble dem around 2am from residents wey say di building collapse don trap many under.

Source