South African goment say dem wan comot Beauty queen Chidimma Adetshina, wey bin dey di middle of one hot nationality kasala of her South African identity and travel documents.
Di Department of Home Affairs bin start to investigate her case afta she become finalist for di Miss South Africa pageant.
Dis dey come sake of di criticism she face, as pipo question her eligibility to compete bicos her mama get Mozambican roots and her father na Nigerian.
She withdraw from di competition for August afta di department announce say her mama fit don commit “identity theft” to become South African citizen.
Ms Adetshina, wey be law student, bin go on to win Miss Universe Nigeria afta di organisers bin invite her to participate for di beauty pageant.
- ‘Dis victory na tap on di shoulder to tell mysef well-done afta wetin I go through’ – Chidimma Adetshina
- Chidimma Adetshina withdraw from Miss South Africa 2024 pageant afta citizenship controversy
- Miss South Africa organisers respond to critics about Chidimma Adetshina qualification to contest
Di Department of Home Affairs bin announce di withdrawal of her ID papers bifor one parliamentary committee on Tuesday, 29 October.
Tommy Makhode, di top civil servant for di department, tok say dem go cancel Ms Adetshina mama documents too, as di two of dem fail to meet di Monday deadline to provide reasons why dem suppose dey eligible to keep dem.
Neither Ms Adestshina nor her mother don comment on di move to withdraw dia papers.
Oga Makhode tok say dem don refer di case to di Hawks, one special police unit wey dey torchlight serious crimes, and di unit don conclude say di mata na “case of fraud” – and officials dey wait on prosecutors to tok how to move forward.
Afta di department revelation for August, dem say Ms Adestshina “no follow for di alleged unlawful actions of her mama as she bin small pikin at di time”.
Ms Adetshina bin tok say dem born her for di South African township of Soweto.
Afta she win di beauty competition for Nigeria, she tell BBC say she still see herself as “proudly South African” and “proudly Nigerian”.
Ms Adetshina just land Mexico to represent Nigeria for di Miss Universe competition wey go hold on 16 November.
She go compete against contestants from across di world, including Mia le Roux, di pesin wey win dis year Miss South Africa contest.