Why court stop CBN from releasing allocation to Rivers goment

Justice Joyce Abdulmalik of di Federal High Court Abuja don stop di Central Bank of Nigeria (CBN) from further releasing monthly financial allocations to di Rivers State goment.

Justice Abdulmalik tok say for Govnor Siminalayi Fubara to receive and disburse monthly allocations since January dis year na breach of di Constitution wey no suppose continue.

According to Justice Abdulmalik, di presentation of di 2024 budget by Fubara bifor a four-member Rivers House of Assembly no dey constitutional.

She say di govnor action na gross violation of di 1999 Constitution.

Di judge bin den stop CBN, di Accountant General of di Federation, Zenith Bank and Access Bank make dem no gree Fubara to access money from di Consolidated Revenue and Federation Account.

For early October, Court of Appeal wey sidon for Abuja bin hold di judgment of di Federal High Court wey set aside di 800 billion naira budget wey five members of di Rivers State House of Assembly Edison Ehie-lead pass.

Court bin throwey di appeal wey Govnor Fubara bin file on grounds say e lack merit.

Di court bin hold say Fubara withdraw im counter-affidavit for di lower court for di mata and as such no fit start appeal for mata wey e no challenge for di trial stage.

For di unanimous judgement, di court bin tok say Govnor Fubara suppose apply di rule of law and no be di rule of might.

Di court further tok say di situation for Rivers State House of Assembly na one executive dictatorship by di govnor.

Justice Omotosho bin cancel di 2024 Rivers budget wey pro-Fubara lawmakers bin pass and set aside di presentation and passage of di Rivers State 2024 budget.

For di judgment, Omotoso bin order Govnor Fubara to present di budget again to di Assembly wey dey under Martin Amaewhule sake of say na im dey constituted.

Di budget title na ‘Budget of Renewed Hope, Consolidation and Continuity’ of 800 billion naira to five out of di over 30 lawmakers of di state House of Assembly for December 2023’.

Justice Omotoso bin also order Fubara to release all funds wey dey accruable to di Rivers House of Assembly and stop di govnor say make e no chook mouth for activities of di Assembly.

Which House of Assembly Inec go obey?

Di drama for di Rivers State House of Assembly no be today, e don dey happun for sometime now.

E take a anoda turn as di two factional Houses of Assembly wey Victor Oko-Jumbo and Martin Amaewhule dey head, hold sitting and move two parallel motions to declare di position of each oda vacant.

Di Martin Amaewhule-led Assembly declare di seats of di lawmakers wey dey loyal to Govnor Siminialayi Fubara vacant.

On di same day Victor Oko-Jumbo-led Assembky insist say Martin Amaewhule and odas no be members of di state Assembly since dem defect for December 2023 and so dem no get any power.

Di both factions dey call on di Independent National Electoral Commission (Inec) to conduct bye-elections to fill dia seats.

All dis na part of di political kasala wey dey happun between Govnor Fubara and im former oga Nyesom Wike, wey be Federal Capital Territory minister.

Source