Key tins wey President Joe Biden follow Tinubu tok on phone

Di president of di United States of America (USA), Joe Biden, don follow im counterpart for Nigeria, Bola Tinubu, tok for phone conversation.

US president bin use di opportunity of di call to condole wit victims of di recent flooding wey claim lives and scata places for di northern part of Nigeria.

Dis call dey come less dan two months to di US election wia American voters go decide dia next president.

According to di statement wey comot from di White House on Tuesday 29 October, President Biden dey appreciate Oga Tinubu for im leadership for Africa.

Key tins dem discuss for di call

  • Flood for Nigeria

President Biden use di opportunity to send im condolence to Nigeria president ova di flood situation wey don impact north-eastern part of di kontri.

For September 2024, heavy flood bin lead to di death of ova 30 pipo for Borno State and e draw global attention.

In fact, di United Nations describe di flood as di most devastating flood disaster in 30 years.

“President Biden offer im condolences on di recent flooding wey get impact for north-eastern Nigeria,” di US tok for dia statement.

  • Release of Binance executive

US president Biden also appreciate Oga Tinubu for how im secure di release of one of di American citizens and former U.S. law enforcement official Tigran Gambaryan.

Remember say Nigerian authorities bin drop charges against di Binance executive, Tigran Gambaryan wey bin dey on trial.

Gambaryan bin dey face money laundering charges and e bin dey detention since April 2024.

Both of dem bin dey detention but Anjarwalla find way to comot.

Dia charges against dem dey to di tune of $35 million wey anti-graft agency, Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bring against dem.

Authorities decision to drop di charges against Tigran follow one serious diplomatic tok-tok between Nigerian and U.S. goment so dem go fit release am.

Meanwhile, Lawmakers for U.S. bin also advocate for im release bifor.

Di White House statement say, “President Joe Biden show im appreciation for President Tinubu leadership to secure di release on humanitarian grounds of American citizen and former U.S. law enforcement official Tigran Gambaryan last week”

  • US-Nigeria partnership

During di call, di two president tok on how di partnership between both kontris dey address global challenges.

Oga Biden particularly express im appreciation to President Tinubu on how di two kontris dey work togeda ontop issues of law enforcement and technologies as dem just announce di ‘Bilateral Liaison Group on Illicit Finance and Cryptocurrencies’.

“Di two leaders also tok about di value of di U.S.-Nigeria partnership to address global challenges and advance security and prosperity across multiple sectors.”

According to di statement, both Tinubu and Biden dey collaborate on new innovations wey go reform ‘international organisations wey go reflect African voices’.

For 2023, similar call like dis bin happun wia Joe Biden bin meet wit Bola Tinubu as dem tok on di relationship between Nigeria and di US.

During dat 2023 meeting between di two presidents, Biden appreciate Tinubu on how e dey lead as chairmo of di Economic Community of West African States (Ecowas) to defend democracy and di rule of law for Niger and oda African regions.

Meanwhile, dis 2023 meeting na part of di G20 summit wey hold for India wia di US say di invitation of Nigeria to di summit na sake of di ‘global importance of Nigeria as Africa largest democracy and economy’.

Remember say President Biden bin send delegation come di inauguration ceremony of Tinubu as di 16th president of Nigeria wen dem officially swear am in for 29 May, 2023.

Na Marcia L. Fudge, di Secretary of di United States Department of Housing and Urban Development, bin lead American delegation afta Biden announce di names of di delegates for Monday 22 May 2023.

Source