Nigeria president Bola Ahmed Tinubu don announce di appointment of a new acting Chief of Army Staff (COAS).
Oga Tinubu appoint Major General Olufemi Olatubosun Oluyede as di acting COAS to takeova from Lt-Gen Taoreed Lagbaja wey neva appear for any public function for sometime now.
According to special adviser on information and strategy to di president, Bayo Onanuga, di new Chief of Army Staff go dey act till Lt-Gen Lagbaja return.
Dis appointment dey come afta plenti tori bin show for social media concerning di whereabouts of Lt-Gen Lagbaja.
But dat time, di Defence Headquarters (DHQ) describe as fake news di report wey bin spread say Chief of Army Staff Lagbaja die of cancer.
According to one statement wey di Acting Director of Defence Information, Brig-Gen Tukur Gusau release for Abuja few weeks back, dem say Chief of Army Staff Lagbaja dey kampe and go soon return to normal duties.
Meanwhile, e no dey stated wen Chief of Army Staff Lagbaja go return and di presidency no also add for how long di new acting Chief of Army Staff Oluyede go act.
- Where Chief of Army Staff dey? Defence Headquarters warn against call for military takeover
- EndSARS: ‘My papa na good police officer but dem kill am during di protest’
Di new appointment of di acting Chief of Army Staff don dey raise questions for mind of some Nigerians.
Oluyede and Lagbaja na coursemates and members of the 39th regular course.
Who be Major General Olufemi Oluyede
Major General Olufemi Oluyede na 56 year old military man wey don serve as di 56th Commander of di elite Infantry Corps of di Nigerian Army wey dey based for Jaji, Kaduna.
Dem commission Oluyede as second lieutenant for 1992 but dey effective from 1987.
E rise to Major-General for September 2020 wia e don hold many commands dem commission as an officer.
Major General Oluyede na former Platoon Commander and adjutant for 65 Battalion, company commander for 177 Guards Battalion, Staff Officer Guards Brigade, Commandant Amphibious Training School.
Dis acting Chief of Army Staff don participate for several operations wey include di Economic Community of West African States Monitoring Group (ECOMOG) Mission for Liberia, Operation HARMONY IV for Bakassi, and Operation HADIN KAI for di North East theatre of operations wia im command 27 Task Force Brigade.
Officer Oluyede don earn many honours for im service for various fields of operations.
Some of dis honours include di Corps Medal of Honour, di Grand Service Star, Passing di Staff Course, and Membership for di National Institute.
Oda honour include Field Command Medal, di Field Command Medal of Honour, and di Field Training Medal.
Bifor dis appointment, Oluyede don receive di Chief of Army Staff Commendation Award wey many officers dey look forward to.