Abba Kyari plead not guilty to allegation of drug trafficking inside NDLEA case

Suspended Nigerian Deputy Commissioner of Police, DCP, Abba Kyari, don plead not guilty to di accuse of drug trafficking.

Kyari make dis plea wen im show for Federal High Court for Abuja wia im trial on drug trafficking dey happun.

Di National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, dey arraign di suspended Deputy Commissioner of Police, before di Federal High Court.

Kyari togeda with four oda police officers dey face allegations of involvement in drug trafficking.

But small twist bin happun as two of di four suspects wey dem catch wit Abba Kyari plead guilty to count 5, 6,and 7 wey border on importation of drugs.

Di agency bin allege say Kyari, di former Police Intelligence Response Team, IRT, and im men, unlawfully tamper with 21.25kg worth of cocaine wey dem bin seize from two drug traffickers dem bin catch.

Afta Abba Kyari plead not guilty, di prosecution counsel (NDLEA lawyer) John Sunday bin say dem dey ready for trial and di expect to get di trial date

E also tell di court say dem go get dia proof of evidence latest tomorrow.

E also want di court to give dem a date to review di facts of di mata.

Abba Kyari lawyer, Kanu Agabi meanwhile argue say dem don file application for bail for di first and second defendant. E say dem file di application on di 1st of March 2022.

E argue say make dem no review di fact of di mata as e no dey for di interest of justice wen di trial still dey go on.

But Sunday di prosecution lawyer say say noting dey prejudicial against Abba Kyari to review di fact of di mata

Wetin be di NDLEA case?

Na four oda officers police bin hand over to NDLEA togeda with Kyari.

ACP Sunday J Ubua, ASP Bawa James, Inspector Simon Agirgba and Inspector John Nuhu. As for ASP John Umoru, police say e dey on di run.

One interim investigation report wey police do, also link two international drug couriers wey dem sabi as Chibunna Patrick Umeibe and Emeka Alphonsus, both males, wey dem arrest for Akanu Ibiam International Airport, Enugu on di 19 of January, 2022 to di mata.

Dem bin land Nigeria airport from Addis Ababa ontop one Ethiopian Airlines flight ET917.

Di arrest bin lead to di recovery of one big quantity of sometin wey dey like powder, wey dem suspect say na cocaine from di two narcotic couriers.

According di report wey di crime unit release, findings of di in-house investigation wey di IGP order bin find reasonable grounds to suspect say di IRT officers wey dey in charge of di operation fit don get hand for some kind mago mago wey dey against dia ethical standards.

Di Police report bin add say di investigation also find say di international narcotics cartel wey get hand for di case get strong ties wit some NDLEA officers for di Akanu Ibiam International Airport, Enugu wey dey dia pay roll.

Di two suspect drug couriers, Chibunna and Emeka bin confam say how dem dey operate be say di transnational drug barons go plan wit di NDLEA officers wey dey duty and send dem dia pre-boarding fotos so dem go fit identify, and clear dem without any wahala, and dem go fit pass airport wit di narcotics wey dem traffic.

Who be Abba Kyari?

One of di operations wey make 46-year-old DCP Abba Kyari wey hail from Borno state for northeast Nigeria blow, na wen im lead di arrest of one notorious armed robber wey dem dey call ‘Ndagi’ a.k.a Spirit.

Spirit bin colobi Numan, di number three biggest town for Adamawa state northeast Nigeria.

For 2005, im join di Mobile Police Force and for 2010 dem post am go Lagos Command.

Kyari become di number two man and officer-in-charge for di Special Anti-Robbery Squad (SARS).

Di squad wey dey fight violent crimes from armed robbery, car theft, kidnapping, gang clashes, sea piracy and terrorism later become notorious for brutality wey lead to di October 2020 End Sars protest.

Oga Kyari serve SARS for five years and e bin win plenti awards sake of im outstanding performance.

Na Abba Kyari team bin gbab di notorious kidnapper, Chukwudi Onuamadike wey pipo sai as ‘Evans’, im bin dey operate one strong kidnapping ring for Nigeria before dem gbab am.