School resumption in Nigeria update today: FG go review 18 January school re-opening day sake of Covid-19

Di Federal Government on Monday say e go review di January 18 earlier date wey e fix for all schools for di kontri to resume.

Di Minister of Education, Adamu Adamu, yan dis one as e dey ansa kwesion during di weekly press briefing by di Presidential Task Force on COVID-19 for Abuja.

Oga Adamu say dis decision na sake of di second wave of COVID-19 wey dey affect di kontri.

Di (January 18 date of school reopening) no dey sacrosanct. Wen we decide on dat date, e just be like target wey we dey work on, we dey keep am in view and di check wetin dey happun for we kontri and dis decision dey subject to review’, im explain.

He further yarn say “Even today (Monday) for di PTF meeting, we chook eye on top di number of covid cases wey di go up and we think am say e good make we take anoda look on top di January 18 resumption, we go review am , we gatz review am and di ministry go take am up on Tuesday.

Di NCDC daily Covid case chart don go up in di last weeks as di number infections dey increase since di beginning of di 2021.

Di PTF bin don yan say di way wey di number of cases dey go up, e pass be careful and dat di increase na sake of say Nigerians no dey obey covid -19 protocol.

Although di task force don kontinu to yan say dem no dey consider total lockdown again for di kontri sake of di economy, dem also explain say if pipo no follow di protocol, goment no go get any oda option.

Di taskforce bin don give students hope say schools go resume on di 18th and even universities across di kontri don begin send notification to dia students to resume class.

But di minister of Education say di January date fit no get head as dem still dey review di resumption date.