Sunday Igboho Ogun State: Sunday Adeyemo say Ooni of Ife disappoint Yorubas, no tell Buhari truth about ‘killer herdsmen’

Sunday Igboho, di popular Yoruba rights activist wey real name na Sunday Adeyemo, say one respected Nigerian King, Ooni of Ife, disappoint Yoruba pipo wen e visit President Muhammadu Buhari recently ova di herdsmen palava.

Sunday Igboho wey dey Ogun State say Oba Adeyeye Ogunwusi, fail to tell President Buhari about di pains of Yoruba pipo.

Igboho [Sunday Adeyemo] tok dis one on Wednesday morning during one computer video alais online Town hall meeting wey im do with Yoruba pipo wey dey outside Nigeria.

Ooni no speak up against di ‘killer herdsmen’ for di region wen e met with President Buhari, Sunday Igboho [Sunday Adeyemo] add.

“Ooni for don follow Buhari tok truth. Wen Buhari meet wit Ooni, e stand up for am from chair, wetin neva happun before. Na there Ooni for don tok di truth but e no tok.”

Di Ooni of Ife, Oba Adeyeye Ogunwusi neva respond to Sunday Igboho on top dis im recent accuse.

Na last week di Ooni bin visit President Buhari sake of di security palava for di south west region.

“Wen dem don give dem money, na anoda thing dem go dey tok. If dem don collect Dollar.””Wen e come back, e dey tackle me say make I leave di mata to goment say na goment go work on am. You sef imagine dat kain tok”Na sake of dat di Alaafin call me make e for tackle am say why Ooni go tok dat kain thing, Na only God fit help us.”

Oba Adeyeye Ogunwusi bin meet with di president afta Sunday Igboho give seven-day quit notice to herdsmen for Oyo state.

Afta di meeting, Oba Ogunwusi come advise Sunday Igboho not to take di laws into im hands.

Ooni say although Igboho don do well to speak for im pipo wey dey suffer but make e allow di constitutional authorities to take charge and handle di security palava.

But oga Igboho say di Ooni nor tok dia concerns and e sama accuse give some politicians say na dem dey behind di Ooni latest move;

“Di Ooni disappoint imself. E invite me to im palace but I refuse to go. I for go if to say e represent us well but e no do am. I no go honour any monarch wey no dey cooperate with me. Enough is enough, di herdsmen don do enough.”

“Ooni no honor imsef, instead of am to speak for di Yoruba pipo, e go dey tok wetin no follow… Politicians don dey wit Ooni dey sponsor am.”

[Fulani herdsmen] crisis background

Clashes between herdsmen and farmers dey cause plenti tension for some states of Nigeria over di years.

Di last clash lead to destruction of property and di killing of one Fulani leader for Oyo state.