‘No justification for flogging my pikin to death’ – Family of student wey teachers allegedly flog to death want justice

Marwan na JSS 3 student for Al Azhar

BBC

Di Family of JSS 3 student Marwan Sambo who lose im life 6 days ago after teachers for Al Azhar Academy for Kaduna state allegedly beat am to death dey call for justice for dia pikin.

Tori of Marwan death make headlines across Nigeria afta tori come out say na flogging and oda punishment for im school lead to im death.

Kaduna state goment for northwest Nigeria don since shutdown di school and order investigation into wetin happun.

Videos and fotos for social media show Marwan wit wounds for im body afta im death wey make many pipo vex.

Di father say Marwan join di school 5 months ago

BBC
Marwan father Mallam Nuhu Sambo say e wan justice for im pikin

Mallam Nuhu Sambo na di dead student papa and e tok say ‘justice’ na di only tin wey im mind for now.

“Wetin we want na justice becos something like dis no suppose happun for school.

“Na just five months ago I enrol am for di school becos na SS1 e suppose enta but unto say di school e bin dey befor don close registration na why e move to Al Azhar.

“But seeing say all im mates dey SS1 while dem only accept for JSS3 come make am dey feel somehow.

“Even on di day dis incident happun wen dem ask am for Assembly why e no dey come school e tell dem say na becos im mates dey SS1 and e dey JSS3 before dem begin punish am.”

Rukayya Sambo na Marwan aunt and na she dey take care of di boy since im mama die few years ago afta she deliver twins.

“Im mama die few years ago afta she born twins and na Marwan be her third pikin before di arrival of di twins wey she born last.”

On di incident wey happun, Rukayya tell BBC News Pidgin say all dem want now na justice for dia pikin so dat oda schools go learn and take example from am.

“We still mourn our pikin and di only tin we want now na justice, make authorities punish those responsible so odas go use am learn.

“School suppose be peaceful place wey pikin go learn to impact society and not place of punishment and death.”

She add say even though Marwan never complain of severe punishment before e get oda students of di school wey dey complain of di school strict ways.

Kaduna Police Command say dem don arrest di Principal and Vice Principal of Al-Azhar School.

Police Command PPRO, ASP Mansir Hassan confamm di arrest for one statement, e tok say Police sabi wetin happen well-well, and dem dey control di situation.

E add say, dem don arrest two pipu wey dey get hand for di matter.

CP don order say make dem do investigation well well so dem go fit find wetin cause di death of Marwan.

Source