‘Wetin sweet my belle na say dem no rape any of my five girls’ – Mama of girls wey bandits hold for seven months

Di mama of di girls share her testimony say dem no rape any of dem

BBC
Di mama of di girls share her testimony say dem no rape any of dem

“Number one thing wey sweet my belle be say dem (di daughters) confam to me say dem no rape any of dem.”

Mother of di five girls wey gunmen release for Zamfara state (northwest Nigeria) on Monday, 7 November, tell BBC say none of di gunmen rape her children despite say dem spend months wit dem inside bush.

Hajiya Hadiza Abubakar express relief as her children regain dia freedom afta gunmen storm dia house for Bungudu local goment of di state.

“Di major hardships dem endure na mosquitoes and oda daily sufferings.”

Tori of di girls kidnap no too make national headlines immediately afta kidnap but months later wen video emerge wey show di girls dey hold guns inside bush na wen e go viral across Nigeria.

Dia father Abubakar Furfuri bin serve as Accountant General of Zamfara state many years ago before e retire.

Di mother tell BBC say she no go ever forget di moment she see her children after dia release from captivity.

“I rush hug all of dem deeply and na so all of us begin cry.”

“Dem tell me say one of di tins wey fear dem na wen di gunmen say dem no go eva return home.”

She also confam say dem pay ransom and no get any helep from goment or oda pipo.

“Nothing like helep from goment, we just sell our properties to raise money to pay.”

Di 5 girls after dia release

BBC
Di five girls with Govnor Matawalle after dia release

Di state govnor Bello Matawalle bin receive di five girls wey security pipo rescue.

Im say na close informants wey fit likely be friends or family members carry information give bandits wey lead to di kidnap adding say na informants dey fuel kidnapping.

E direct say make di girls dey hospital for di next few days in order for full medical check up to happun before dem re-unite dem with dia families.

Security crisis for Zamfara 

For over a decade now Zamfara state neva see sustained peace over a period as banditry and kidnapping continue to trouble di state.Almost every week one tori or anoda of killings and kidnappings dey comot from di state.

Di problem really start around 2011 during administration of govnor Abdulaziz Yari but as di kontri dey also face heavy wahala from Boko Haram dat time di major focus no reach dat side.

And some analysts say na wetin make di problem escalate be dat as federal goment no tackle di mata when e start and now e don really spread to many states across northwestern Nigeria.

Oda notable attacks wey don wire di state.

  • 8 February dis year na several pipo die after bandits attack Hayin Dan Maciji village. One mother from di village tell BBC at di time say she still neva see her five children after di bandits attack.
  • 8 June 2021, gunmen kidnap about 60 women from some villages inside di state.
  • 12 September 2018, gunmen kill at least 13 pipo and injure more than 20 odas for one attack inside Tsafe town.

End to di banditry dey in sight?

Di decade long problem don cause serious wahala from closure of schools due to kidnappings to crumbling of economic activities in many areas.

Sani Shehu na social commentator and e tell BBC News Pidgin say federal goment must up dia game for dis problem to end.

“At di moment wetin federal goment dey do is not enough and di proof na say bandits attacks still dey happun so if dis problem go end finally na for goment to up dia game and fish dis bad eggs out from dia hiding places once and for all.”