South Africa president Cyril Ramaphosa cabinet – who go dey inside?

Cyril Ramaphosa

Getty Images

Di pipo of South African dey wait anxiously to know who go dey President Cyril Ramaphosa cabinet despite di coalition wey happun bifor im inauguration.

South Africa parliament bin re-elect Cyril Ramaphosa as di kontri president afta a landmark coalition deal between di governing African National Congress (ANC) and opposition parties.

Dem form a new goment of national unity wey consist of Ramaphosa ANC, di centre-right Democratic Alliance (DA) and smaller parties – afta di National Assembly vote to confam who go hold power for di new administration.

But now wey President Ramaphosa suppose announce dos wey go dey im cabinet, gbege don happun between di ANC and DA ontop di sharing of positions.

Meanwhile, Ramaphosa for im victory speech bin hail di new coalition, and tok say voters expect di leaders “to act and to work togeda for di good of evri one for our kontri”.

Dem strike a deal as dem form di coalition wit ANC wey lose dia parliamentary majority for di first time in 30 years.

ANC bin get 40% of di vote, while di DA come second wit 22% and oda small parties follow.

On 19 June 2024, Chief Justice of South Africa Raymond Zondo administer di oath of office for Ramaphosa wey make am president for second term.

Wen president Ramaphosa go announce cabinet

Di next step na for make president Ramaphosa allocate cabinet positions wey go include members of di DA and odas wey join body form di coalition.

According to local media, president Ramaphosa dey expected to announce who go form di new cabinet for South Africa—but delay don push am reach Friday once dem finish dia negotiations.

Di main negotiations between ANC and DA wey still dey resolve dia issues wey concern di sharing of power.

Tori be say di Democratic Alliance dey demand ogbonge position wey get influence for di new goment. And some of di positions include deputy presidency and plenti ministerial positions.

How di mata take waka be say, since ANC party no manage to pass di 50% mark for di votes, dem gatz to gree on a coalition wit anoda party or parties for di first time to co-govern di kontri and re-elect Ramaphosa for second term.

Who go dey Ramaphosa cabinet

President Ramaphosa go announce who go dey im cabinet for di 7th administration for South Africa.

Even as e neva clear wen Ramaphosa go announce im cabinet, but e don dey expected for South Africans to know.

Di leader of di DA party John Steenhuisen say dem want a goment wia dia party go get a fair deal and dem go fit ‘ply meaningful role’, according to News24.

According to Reuters, DA party dey ready to work out a deal for Ramaphosa cabinet and dis na afta reports say di two parties wan collapse over issues wey concern cabinet positions.

One party source wey dey close to di tok between ANC and DA tell Reuters on Friday say coalition tok don dey “almost done”.

Di parties wey dey expected to form di South Africa cabinet include:

  • Democratic Alliance (DA) wey win di second most votes wit 21.8%
  • uMkhonto weSizwe (MK) party wey get 15% of di votes.
  • Economic Freedom Fighters (EFF) wey get 9% votes

Oda parties like IFP, Patriotic Alliance (PA) and some oda smaller ones wey support di nomination of Ramaphosa as president go expect make di president reward dia parties wit appointments.

Meanwhile, for 2019 wen Ramaphosa bin first win di South Africa election as president, na about four days e take am to announce im cabinet members.

But now, e don pass seven days and di president neva make any cabinet announcement sake of gbege wey dey happun wit di coalition.

ANC Secretary-General Fikile Mbalula, write for X say di negotiations dey “Almost done wit GNU discussions.”.

Mbalula add say “e go dey done as promised.”

Meanwhile, South African media dey report say di kontri currency dey affected e dey show for di financial market.

President Cyril Ramaphosa inauguration

Cyril Ramaphosa take oath of office to become di president of South Africa for di second term at di Union Buildings on 19 June 2024.

Di theme of di inauguration na “30 Years of Democracy, Partnership and Growth.”

Chief Justice Raymond Zondo administer di oath of office on Wednesday during di inauguration.

“Ladies and gentlemen, di President of South Africa”, di chief justice tok a im raise di hand of Ramaphosa.

South Africa parliament re-elect Cyril Ramaphosa as di kontri president afta a landmark coalition deal between di governing African National Congress (ANC) and opposition parties.

Source