Germany top table as dem play draw with Switzerland inside ogbonge group game

Late goal from Germany player Niclas Fullkrug give Germany 1-1 draw against Switzerland for di ongoing Euro 2024 championship.

Fullkrug score for added time to help Germany share points wit Switzerland.

Switzerland bin dey lead from di 28th minute wen Temo Freuler score.

Germany top Group A while Switzerland finish second.

For di oda match, Hungary score late goal for di 100th minute to send Scotland home.

Hungary must press calculator and hope to progress as a best third place finisher, while Scotland journey don end.

Second Half

Full Time Switzerland 1-1Germany

90+4 match don end.

90+ 2 GOAL! Germany score as Niclas Fullkrug slip di ball pass di goalkeeper.

90’ Referee add four minutes.

88’ Granit Xhaka of Switzerland attempt to score wit im first time shot from di edge of di box but Manuel Neuer Germany goalkeeper save di ball.

85’ Toni Kroos play corner kick but e result to goal mouth scramble, Kai Havertz header bounce go over di bar!

84’ Ruben Vargas of Switzerland score goal but linesman say na offside.

82’ Leroy Sane of Germany get beta chance inside di box afta ball comot from defender leg but e play di ball go wide of di left post.

81’ Silvan Widmer of Switzerland don collect yellow card for back tackle against Germany, im go miss di next game.

78’ Ruben Vargas play free kick for Switzerland but notin come out.

76’ Double substitution for Germany, Leroy Sane don enta for Florian Wirtz, Jamal Musiala don comot Niclas Fullkrug.

74’ Gundough commit foul and referee give Switzerland free kick.

72’ Match don pause as dem call referee to check VAR but VAR say NO PENALTY for Germany. Match continue!

71’ One of Germany player dey near goal but one defender stop am for inside di box but referee say NO PENALTY!

70’ Joshua Kimmich miss chance to score as defender block im short pass wey near goal.

68’ Kai Havertz jump to head one cross to di goal post but e go over di bar.

67’ Granit Xhaka collect yellow card afta e make im opponent fall for ground.

65’ Double substitution for Switzerland Kwadwo Duah enta for Embolo, while Maximilian Beier replace Robert Andrich.

63’ David Raum wey just enta now now for Germany strike di ball towards goal from long distance but e go over di bar!

61’ Substitution for Germany, Jonathan Tah don comot and Nico Scholotterbeck replace am. Maximilian Mittelstadt time don finish for field, David Raum don enta.

60’ Toni Kroos of Germany dey try im best to score but Switzerland defenders no dey let am rest.

59’ Germany get corner kick, Toni Kroos play am but notin come out.

57’ Switzerland player Remo Freuler commit foul and referee blow whistle.

55’ Germany player Antonio Rudiger give away foul for one yeye challenge.

54’ Toni Kroos of Germany pounce on one bouncing ball for di edge of di box but di ball go wide towards di left post.

51’ GunRogan of Germany play one rebound for di edge of di box, e shoot di ball but e go wide.

51’Germany player Musiala run meet one ball wey scata di Switzerland defence, im fire shot towards di middle of goal but Yann Sommer Switzerland goalkeeper clear di ball.

49’ Breel Embolo of Switzerland run pass am yet im no fit keep di ball in play.

47’ Silvan Wilmer of Switzerland try to catch one thru ball but e too long for am.

46’ Second half don start.

First Half

Switzerland 1-0 Germany

45 + 3′ First half don end.

45′ Two minutes of added extra time.

43′ Andrich shot from di edge of di box na waste and e go wide.

42′ Havertz chest di ball den volley am high over di bar from inside di box.

42′ Rudiger get chance with one cross from di wing, but im header no sure and di ball go wide,

41′ Florian Wirtz take corner kick for Germany.

34′ Toni Kroos take am, but defender clear am.

33′ Andrich fire shot from distance, but defender block am. Linesman give Germany corner.

Switzerland 1-0 Germany

28′ GOAL! Ndoye score for Switzerland.

Remo Freuler play am to Dan Ndoye and fire shot past Manuel Neuer into di top left corner.

25′ First Yellow Card of di match dey awarded to Ndoye.

20′ Michel Aebischer take am, but na poor cross and one of di defenders clear am easily.

20′ Antonio Rudiger do one aggressive challenge and referee blow whistle for foul. E award free kick to Switzerland.

19′ VAR DISALLOW di goal sake of foul.

18′ Haaa… di referee dey go VAR to see if dem go award di goal.

17′ GOAL! Germany Robert Andrich don score!

16′ Referee blow foul for Granit Xhaka wey do one rough challenge.

14′ Kai Havertz fire one precise shot from inside di box wey bin dey blocked by a defender. But di linesman say na offside, so nothing for come out of am.

11′ Gundogan fire one shot from di edge of di box, but defender block am.

10′ Ndoye slide one pass forward, but defender block am.

8′ Germany get ball possession now and dem dey make some precise passes.

4′ Fabian Rieder take am but Germany defence clear am.

4′ Dan Ndoye try to slide di ball give im teammate but defender block am. Di ball go out of play. Switzerland get corner kick.

3′ Toni Kroos take am. Kai Havertz jump high to meet di ball and head am towards di middle of di goal. But e no get enough power and di keeper save am. Small tin.

2′ Ilkay Gundogan almost get chance after Germany Jamal Musiala try to send one pass, but one of di defenders react well and stop am. Germany get corner kick.

1′ Switzerland Fabian Rieder collect ball from opponent but e para wen di referee call foul.

1′ Referee Daniele Orsato don blow. Match don start.

Switzerland 0-0 Germany

Line Up

Switzerland XI: Sommer, Widmer, Akanji, Embolo, Freuler, Xhaka, Rodriguez, Ndoye, Aebischer, Schar, Rieder.

Germany XI: Neuer, Rudiger, Tah, Kimmich, Havertz, Kroos, Musiala, Wirtz, Mittelstadt, Gundogan, Andrich.

 Gundogan and Musiala

Getty Images

Match stats

Switzerland bin neva lose any match for dia past three matches against Germany. Dem win 1 draw 2.

Dia previous three matches produce 16 goals, an average of 5.3 per game. Di Swiss bin don lose 16 of dia previous 18 matches against di Germans.

Switzerland bin also neva lose dia final group stage game for any of dia past eight appearances for a major international tournament. Dem win 5 lose 3. Dia last na for Euro 2004 (1-3 vs France).

Switzerland don lose just one of dia past 12 games for European Championships – and na 3-0 loss to Italy for Euro 2020 – but since Euro 2016, di Swiss don draw more games for di competition dan any oda side (W4 D7).

Only Portugal Cristiano Ronaldo don score for more major international tournaments dan Switzerland forward Xherdan Shakiri, wey don score for each of di past six tournaments since and including di 2014 World Cup (Euro 2016, 2018 World Cup, Euro 2020, 2022 World Cup, Euro 2024).

Jamal Musiala dey aim to become di first German player to score for each of im nation opening three games for major tournament since Miroslav Klose for di 2002 World Cup and di first ever to do so for di European Championship.

Im go dey 21 years and 118 days on Sunday, im go be di second youngest player ever to do so for any nation behind only Peru Teofilo Cubillas wey dey 21years and 94 days for di 1970 World Cup.

Source